• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

Tori of coup plot for Nigeria na lie – wetin be di Guards Brigade wey Defence Headquarters tok about

Sisi Eko by Sisi Eko
February 26, 2024
in Nigeria
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Nigeria Defence Headquarters don hala say tori wey dey spread round say high alert don dey sake of coup plot for Nigeria na lie.

Di fake tori bin add say di suspicion na im make dem call emergency meeting wey President Bola Tinubu bin dey inside.

Oda pipo wey dem allege say bin dey di meeting na di chief of staff to di President and di Commander of di Guards Brigade.

For statement wey dem release on Monday, dem reveal say di tori wey comot on Sunday say, “di Guards Brigade don dey put on high alert on top unusual movement wey cause suspicion of coup plot for Nigeria”, Brigadier General Tukur Gusau, acting Director Defence Information tok for statement e sign on Monday.

Defence Headquarters add say dem “wish to categorically state say di allegation dey false.”

Dem explain say di Guard Brigade work na to protect di seat of power wey be di Presidency.

Becos of dat work, dem dey also protect di Federal Capital Territory so dem always dey on high alert.

Defence Headquarters also don comot to say dem go go court on top di pipo wey face di fake tori.

Dem say na because do pipo bin do am to create unnecessary tension for di kontri.

Already, Chief of Defence, General Christopher Musa don come out on different times to clear pipo on how members of di armed forces tanda gidigba on top di protection of Nigeria.

For West Africa, na three different kontris currently dey under military occupation, Burkina Faso, Mali and Niger.

Nigeria currently dey for middle of high cost of leaving as floating di naira currency, don lead to major drop in the value of di currency against di dollar.

Recently, thousands of Nigerians enta streets for di northern states of Niger, Kano and Kogi and Oyo for western Nigeria, to demand urgent interventions wey go address di rising cost of living as dem claim say di situation don become unbearable.

Price of food items dey increase for dia fastest rate in nearly 30 years.

Official record from di Nigeria National Bureau of Statistics (NBS) report say inflation dey at 29.9%, di highest in almost three decades, and food inflation tanda for 35.4%.

On top of dat, di power industry for Nigeria wey don be major wahala for di kontri be like e don turn worse.

In fact, di national grid don collapse at least four times between September 2023 and February 2024.

So already tension don dey build for di kontri.

Wetin be di work of di Guards Brigade

Di Nigerian Presidential Guard Brigade na unit of di Nigeria army wey dia main work na to protect di seat of power, wey for Nigeria be di Presidency.

Dis also mean say apart from di person of di president, di work of protecting di presidency also extend to anyone wey fit take ova presidential duty, like Vice President, Senate President and Speaker of House of Representatives.

E also include pipo wey dey close to di president like di First Lady of Nigeria.

Dem dey also work with Nigerian Police to secure areas for di Federal Capital Territory.

Di Nigerian Guard Brigade also get di work of mounting di guard of honour on behalf of armed forces for important national events like di Armed Forces and Independence Day.

Timeline of West African coups wey don happun

For May 2021, Col Assimi Goïta seize power from di transitional goment say dem wan scata di kontri transition to democracy.

Na di same bin organize di 18 August 2020 coup wey pursue di elected head of state, Ibrahim Boubacar Keïta.

For September 2021, one surprise military coup for Guinea end di controversial tenure of President Alpha Condé, less dan one year afta e win third term wey follow deadly protests and serious restriction on di opposition.

Members of di elite Special Forces (GFS) bin detain 83 year old Condé on September 5, hours afta dem report gunfire near di presidential residence for Conakry.

GFS Commander Colonel Mahamady Doumbouya confam di takeover on top di state TV and promise to conduct peaceful transition.

Burkina Faso bin go through two coup wey work within nine months of each oda.

For 30 September 2022 Captain Ibrahim Traoré overthrow Lt Col Paul-Henri Damiba afta e accuse am say e fail to fulfil im promise to stop di Islamist insurgency wey don hold down Burkina Faso since 2015.

Damiba bin take ova power for January of dat year.

For July 2023, sojas go to detain di Niger President Mohamed Bazoum for military coup.

Dis na wen General Abdourahmane Tchiani don declare imself di new leader of Niger afta di coup.

For 26 August 2023, Gabon oin di ist of kontris to abandon democracy wen Gen Brice Oligui Nguema comot President Ali Bongo from power lock am inaisw house arrest.

Na later in September dat same ear wey dem announce say dem don release am for health reasons.

Court directive to DSS, oda tins wey happun as Ipob leader Nnamdi Kanu trial start

Tags: NewsNIGERIA
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version