Tuffgig music empire na name wey dem sabi for entertainment industry wey don Dey teytey and e still Dey work to dey help teach people wey new for d kyn work make dem grow reach high level.
As tuffgig don get many many better things wey dem don gather upon say dem don see many shege since dem start, dem still dey try push deir musicians make dem dey put effort for d work dey write dey produce better music so e go dey totori d people wey dey hear am con be say na deir target be dat.
Na Hardy Jimbaz wey b d ogapatapata producer wey sidawn form dis ogbonge entertainment wey don turn smal play play to real life.
People wey dem don sign for this ogbonge label na Belliyah a.k.a First lady and person wey follow na Ice sleek a.k.a Industry pikin. Two of dem get special talent and dem dey showcase am wit deir voice and skill for people.
Belliyah voice dey very calm and nice wey follow get love people dey cal am afro soul and afro R&B singer don already pass levels. Dis popular upcoming musician wey don follow for Nigeria best female artist don dey get d kyn hype wey she suppose get.
Ice sleek wey dem dey call new pikin for d house na d person wey come new join Tuffgig music empire and tuffseed. Na him b one of Nigeria baddest upcoming artist wey hin music skills dey show for eye. Ice sleek don dey strong for ground dey get better respect for d whole world.
As Tuffgig music empire dey gather create big big work as time dey waka, d force and market dey make am comot jagajaga and make e dey create new new things for dis music world.