Site icon ilenkogossipparrot

Tuffgig First Lady, Queen Belliyah don scatter internet as she dey yarn us about her new jam

Belliyah b musician wey pipu know cos of d way her afrobeat music dey and even how she take join traditional afrobeat music wit our present day vibe e con dey bring dis confam gbedu wey oda afrobeat singers dey get.

Na for Naija she take grow dey begin sing since she begin waka, as gbedu dey always move am and she con get dis bond wit music.

Her music na traditional afrobeat sound like dem africa drum and oda drums even present day vibe all of dem join. she dey sing for english and pidgin wey dey make her music get dis sharp sound wey dey international and confam naija.

She na one of d signee wey der under Tuffgig music empire wey deir leader na Hardy Jimbaz and she get many many songs wey dey her name wey dey under TME, she con add dis new jam wey she call NO BODY wey dey give am ogbonge face for her talent.

Lai dis so e get many many tins wey dey show for her as she dey steady dey produce beta gbedu.

Make una listen to her new jam NO BODY

https://linktr.ee/tuffgigbelliyah

Exit mobile version