• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Suspected Boko Haram insurgents kill pastor, five odas for Yobe State

Sisi Eko by Sisi Eko
January 5, 2024
in News, Nigeria
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Suspected Boko Haram insurgents don kill one pastor Luka Levong of di Church of Christ In Nations (COCIN) for Kwari, Geidam Local Government Area of Yobe State, northeast Nigeria.

Di attackers also kill five oda pipo.

Channels Television report say some residents wey carry dia bodies go deposit for Specialist Hospital Geidam tell dem say di attackers invade di community around 2:00 am on Friday, 5 January, shoot di pastor and im church treasurer Maina Abdullahi.

According to di resident wey Channels TV quote, dem kill di oda victims for dia separate houses one afta di oda before di arrival of the security men. Di jaguda pipo also burn many houses including one church and vehicles.

Both di military plus di Nigerian Police Force (NPF) for now neva comment on di incident.

Di tok-tok pesin for Yobe State Police command, Dungus Abdulkarim tok say na Nigerian military get right to tok about fight against insurgency for di state.

Geidam dey located for 177 kilometers outside Damaturu, di state capital, and e dey about 40 kilometres away from Nigeria/Niger Republic border.

Di incident dey come days afta Boko Haram insurgents attack one community for neighbouring Yobe State, kill 12 pipo and injure two odas.

Di attack happun for Gartamawa community of Chibok Local Government Area wey dey 125 kilometres from Maiduguri, Borno State capital.

“Di terrorists bin storm di community of Gatamarwa around 5pm on Monday, 3 January, during di New Year celebration, heavily armed wit AK-47 rifles, come wit motorcycles and Hilux vans, and open fire on mourners wey dey come back from Gatamarwa.

“Dem later attack anoda Tsiha community near Shikarkir and kill three pipo, dem also kidnap one young lady, burn houses and dia foodstuffs,” Channels Television quote one source wey follow dem tok.

At least 40,000 pipo don die and more dan two million odas dey displaced since di terrorist group launch rebellion for 2009.

Di insurgency don spread into neighbouring Chad, Niger, and Cameroon, wey don make goment set up regional force to fight di militants.

FG confam death of Nigerian student for Canada afta police shoot am

Tags: Boko HaramNIGERIA
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version