• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Supreme Court declare Sim Fubara as di validly elected govnor of Rivers state

Sisi Eko by Sisi Eko
January 25, 2024
in News
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Supreme Court don confam Sim Fubara as Rivers State govnor.

Di highest for Nigeria dismiss di appeal wey Tonye Cole of di All Progressives Congress file over di 18 March 2023 governorship election.

Oga Cole challenge di election of govnor Fubara for di election wey di Independent National Electoral Commission (Inec) conduct for di state.

For di final result Fubara poll a total of 302, 614 votes to defeat im closest opponent, Tonye Cole wey score 95, 274 votes.

E allege say Fubara bin no resign im former position as Accountant General of Rivers State, and im continue to dey sign official goment documents even afta im don emerge as PDP flag bearer.

Both di tribunal and the Court of Appeal bin dismiss Tonye Cole appeal for lack of merit.

For di final judgement Justice Ibrahim Saulawa tok say Tonye Cole no fit prove im allegations of non-compliance wit di electoral act wey e bring against Sim Fubara.

Political crisis in Rivers state

Di Supreme Court judgement on di Rivers state governorship election mata dey happun as di state dey manage one political kasala.

Di fight na between govnor Fubara and im former oga Nyesom Wike, wey be di FCT minister.

Kasala bust wen tori come out say some members of di Rivers state House of Assembly wan impeach di govnor. Di majority lawmakers say di govnor no dey behave well – na so dem start di impeachment process.

Oga Fubara resistance lead to series of protests and court cases for di state. E also lead to di attack of di state assembly complex and later demolition.

E take di intervention of Nigeria president Bola Ahmed Tinubu wey initiate one ‘8-point agreement’ to resolve di mata between di govnor and di minister.

While e be like say di di two groups dey implement dia parts of di agreement, e still dey clear say di mata neva resolve.

Federal High Court for Abuja on Monday order all parties for di Rivers State Assembly crises to maintain status quo.

Di court for ruling wey Justice J. O. Abdulmalik deliver say make di parties no take any further steps, until di determination of one application wey dey seek to stop Governor Siminialayi Fubara from re-presenting di already passed 2024 budget of di State before di legislative house.

Justice Abdulmalik fix 28 February 2024 to hear di application wey some elders bring before di court.

Di court order come just afta anoda Federal High Court for Abuja bin bar govnor Siminialayi Fubara from interfering wit Rivers state assembly wey Martin Amaewhule dey lead.

Di Court also bar National Assembly from entertaining any request from di govnor to take over activities of di Rivers Assembly.

Wetin we know about di fresh kasala wey claim pipo lives for Plateau State

Tags: NewsRivers State
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version