Award winning naija singer, Temilade Openiyi wey people sabi as Tems don finally reply people wey tok for sociomedium say she get belle.
Few days ago the singer been dey trend for one video for sociomedium wey e be like say her belle don big like say she get belle.
Them been dey hail am for one of her songs wey she sing “Try me” till people con dey notice another thing wey be like say she get belle.
The kyn video wey people see con make dem dey tok tok many things and even some people sef too say na one Oyibo rapper, Future wey give am d belle.
The 28 year old singer con enta Twitter (X) con drop message for them.
Na so she tok am: “Las las all of una dey craze”

Naija lady dey para say her man dey waka naked for house when her friends dey(Read full gist)