David Adeleke bi Nigeria superstar singer, aka Davido don unfolllow hin PA, Isreal DMW, on instagram. Dis kyn tin bin shele afta hin PA go beg muslim people coz of d music video wey Davido post.
Before d whole tin sup, Davido bin drop smal part of hin gbedu video for twitter so hin go fit promote hin new pesin, Logos Olori.
D music video of hin new song ‘Jaye Lo’ don vex plenty people cos say pesin wear jalamiya dey pray for d video dey dance for front of mosque. Dem con see d kyn video as somtin wey dey yamayama deir religion na why dem begin drag am (Nothing wey musa no go see for gate).
Davido con answer dem muslim people as hin go comot d video for socia media but hin no tel dem sorry.
To con make everytin dey wella for everybodi, Davido PA, Isreal con go for hin IG tori dey beg dem cos of wetin hin oga do. Hin tok say the video na jus for cruise say dem no drop am wella. Hin con dey confess love giv muslim people.
Na so hin take write am ” make i apologize giv my muslim broda and sista for d kyn video my oga bin post. Na entertainment wey dem dey do but dem no put am wella. abeg make una no vex. i love una”.
Afta d whole tin, Davido con go unfollow am for ig. As e dey so we no know why hin do am.
Make una see d screenshot for down,
https://www.yabaleftonline.ng/davido-unfollows-israel-dmw-apologised-muslim-community/