Kaduna state police command don rescue victims wey dem kidnap for Kidandan village, Giwa LGA.
The person wey dey epp Command ASP, Mansur Hassan tok con drop the news for reporters on Wednesday 15 November say na vigilant police officers wey find the people wey dem kidnap on November 13.

As police con choke for road, na e make the kidnappers con japa leave the people wey dem carry out for moto.
Dem been kidnap those people since October 3 as dem dey travel along kaduna-Abuja expressway.
Laidis now, all of the people wey police help don Dey with their families. Everybody con dey happy as dem been see their people again.

Na so popo con see another man wey be like person wey dem don beat hin life comot for hin body and hin face be like person wey put puff puff for mouth.
As dem con question am, hin tok say person been collect hin okada for hin hand con use hammer scatter hin body.
Omo na so the popo con trace the matter. Dem later arrest the thief for Bagadaza Dogarawa of Sabo Garin Zaria LGA.
Popo even collect the okada give the man and the hammer wey d thief use.
ASP Mansur Hassan don tok say investigation for the matter still dey shele as wey dey so.
He con later tell everybody say make dem support for the peace and security for the society