Popular naija singer, Naira Marley don tok say after hin former signee Mohbad been drop video say hin dey after Mohbad life, Mohbad con drop apology give am.
Una remember say Mohbad tok say dem suppose hold dem marlian group for anything wey happen to am.

Afta the death of hin former signee, Mohbad on September 12, people con dey point hand for Oga of marlian group say na him kill am.
So for one interview wey Naira Marley wey be d Oga of marlian group been get with Reno Omokri hin tok say he been see the musician after the whole video wahala wey the musician post and he get proof say dem dey on the same ground before anything been happen to am.
He con add tok say he been no dey country when the musician die and e no get anyway wey he fit dey responsible for the musician death.