Site icon ilenkogossipparrot

See wetin Governor Sanwo-olu tok about Lagosians

D Lagos state government don tok say dem go comot money from transport by 50% for all state owned transportation so e go bring down d things wey loss of fuel subsidy don cos.

Dis one bin happen afta dem say administration of new president Bola Ahmed Tinubu no go work again as dem still Dey pay for fuel subsidy. Because of wetin Dey happen, Nigerians con dey try struggle get wetin go b if dem comot fuel subsidy. (Make Una no mind my big big grama)

Legit.ng don follow tok say Sanwo-olu don already announce d kyn 50% reduction from Thursday February 9th 2023 as part of d kyn things wey government wan do epp nigerians coz of d fuel scarcity and shortage of naira.

Governor Babajide Sanwo-olu don tok for conference on July 31 2023 say d new development go begin start on Wednesday 2nd August 2023.

People wey no too get go con collect palliative (things wey fit reduce suffer suffer)

D Governor con add say dem dey try do deir best make people collect palliative so e go epp reduce d shege wey Nigerians don see coz of fuel mata. Hin con tok say people wey no too get sef go collect food.

Lagos state Governor say dem get plans to comot 25% money from Danfo(yellow bus). Also hin go comot 50% for BRT bus dem

People go get oshofree BRT transport for Christmas and new year time for people wey dey stay for Lagos and e go start from Saturday 25th December 2021 and Saturday 1st January 2022

https://www.legit.ng/business-economy/industry/1546826-fuel-n617-lagos-state-announces-50-transport-cut-commuters/

Exit mobile version