Site icon ilenkogossipparrot

See wetin DSS carry IPOB Nnamdi Kanu go do

Barrister Ifeanyi Ejiofor wey bi advicer to Nnamdi Kanu, arrested leader of Indigenous People of Biafra (IPOB) don tok say the leader don go for hin health checkup for d place wey hin wan do am.

D barrister tok say Nnamdi Kanu bin go do d checkup for hospital wey no get name for Abuja on Friday July 28, Premium Times con write am on sunday july 30.

IPOB leader Nnamdi Kanu don finally see hin own doctor for outside DSS place

Ejiofor tok say the kyn meeting with hin client and hin perosonal doctor bin happen outside from wer Department of State Services dey(DSS).

D barrister con add say hin bin see d whole checkup with hin koro koro eyes and everything bin go wella.

Hin con add say as e dey so say d judgement go dey go d next level asap.

As hin take tok am:

“We dey happy to tel una say Onyendu Mazi Nnamdi Kanu don see hin doctor on friday for one hospital for Abuja away from wer DSS dey. So as part of d whole thing, i con see d health checkup with my own eye. The thing bin go wella and productive and Kanu go dey reach d next level sharp sharp”.

Dis whole sedemende bin com from court order afta days don pass.

Remember say federal high court don alredi tell DSS say make dem leave Kanu make hin go do d health checkup for d place wey hin wan do am even as hin still dey for kirikiri.

Justice Binta Nyako on thursday july 20 believe say Kanu get right see any doctor wey hin wan see as e dey under fundamental human right provision of the Constitution, Daily Trust newsapaper bin write am. (na so so grammar ful here)

https://www.legit.ng/nigeria/1546684-breaking-nigerias-secret-police-dss-releases-ipob-leader-nnamdi-kanu/

Exit mobile version