Site icon ilenkogossipparrot

See wetin Deeper life pastor do because say Kumuyi support Tinubu

The pastor wey hin name na Ogueze Chinyerugo say hin no wan be pastor and member for deeper life church because say Kumuyi wey be their General Overseer dey support President Bola Ahmed Tinubu.

Dis one been sup afta Kumuyi dey ring bell say hin support Tinubu say make Nigerians sef join support am say beta beta things go still show for hin regime.

PM news sef join tok say the pastor dump d church day he no dey do again because of wetin hin GO tok.

From Daily trust on 22nd of august, Kumuyi been dey follow newsmen dem dey tok because of d global crusade wey dem dey do say make Nigerians forget wetin Former presidents do before and accept dem back.

So as the cleric con hear am, e con be like say Kumuyi dey support Tinubu and hin wan make Nigerians suffer wella.

This one na some part wey dey for inside d letter wey pastor Chinyerugo write.;

”I Dey write this letter with overload worry as I know say this one pass spiritual mata. E be like say our Father in d lord and Oga patapata, Dr WF Kumuyi don make one big mistake and e no get any way I fit tok my mind give am na why I no wan be una pastor for una church. I no go work from 23rd august 2023.

Exit mobile version