ilenkogossipparrot

See d kyn girls wey I Dey carry for stage- Ruger

Naija singer, Michael Adebayo Olayinka wey people sabi as Ruger tok say even as hin and woman dey always rock yansh for stage say before hin tell any girl make she come dance with am, say hin team dem go first check weda she Dey of age.

E never tay when d musician tok am for one interview for zero condition podcast.

According to him, hin say before he carry any woman come stage say hin team dem go first check weda she don pass 21 years and him sef go ask d girl weda she wan dance with am or she no want.

Ruger tok say oda musicians dey carry woman for stage but when hin turn reach, people go dey get problem with am.

Na so he take tok am:

“I no be d first musician wey don do am, many sef dey do am and dem no go drag dem but cos say na me, dem go con dey drag me. For stage my team dem dey always check d girls ID make dem confam say dem don pass 21. If u b 18 19 u no fit climb that stage. And I Dey always ask dem if dem wan dance and dem go say yes dey joli. I go stand na dem go con put body for my body. People just wan tok cos say na me”.

Exit mobile version