• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

Protest don ever solve any problem for Nigeria?

Sisi Eko by Sisi Eko
February 28, 2024
in Nigeria
0 0
0
0
SHARES
3
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Nigeria workers bin come out on Tuesday to protest against high cost of living, insecurity and oda tins wey dey affect workers.

Di protest wey di Nigeria Labour Congress describe as peaceful rally happun across di kontri.

Abuja, di Nigeria capital lead di protests as states like Lagos, Rivers, Kano join bodi wey see pipo showface well well.

Di protest wey suppose happun for two days, no go happun on Wednesday again.

Dis dey come afta NLC review di execution of di first day of di nationwide protest to assess how effective e be .

For inside statement wey NLC President Joe Ajaero and Acting Secretary Bello Ismail sign, di labour union resolve to

“Suspend street action for di second day of di protest sake of say e achieve overwhelming success and reach di key objectives of di 2-day protest for di first day.”

Dem add say di Nationwide action go kontinu on Wednesday but no be street protests.

“Press Conferences go happun cross all di states of di federation by di state Councils of di Congress including di National Headquarters.

To reaffirm and extend di 7-days ultimatum by anoda 7 days wey go now expire on 13 March, 2024″

NLC add say during dis period goment dey expected to implement all dia earlier agreement wey bin happun on 2 October, 2023 plus oda demands wey dem present for dia letter during di nationwide protest on Tuesday.

Protests for Nigeria

Protests for Nigeria be like bread and butter, e dey hard to separate dem, dis na because na common tin wey dey happun almost evritime.

Any group wey dey para, from di education sector to health sector, to di petroleum sector, all dey rely on protests.

Anoda form of protest na industrial action (strike) wey Nigeria dey also witness all di time.

Some of di ogbonge protests wey don happun in di last five years na di popular Endsars protest for 2020.

Nigerian youths bin enta streets across di kontri to protest against police brutality. 

Dis protest really shake di kontri and draw di attention of international communities.

Di Academic Staff Union of Universities protest wey dem joinbodi do wit Labour for 2022 to help lecturers get wetin dem dey demand from goment.

National Association of Nigerian Students protest for 2022,dem call goment to call off strike.

Di ASUU strike bin last for over 7 months and students bin dey para as dia life bin dey on stand still.

Out of all dis protests no one really succeed 100 percent, for each case goment try calm pipo down, torchlight di situation but for most of dem notin comeout.

Protesters don ever achieve dia aim?

Out of all di protests wey dey happun all di time for Nigeria only few don achieve di objectives.

One of di protest wey bin succeed na “Occupy Nigeria” wey happun for 2012 under former president, Goodluck Jonathan.

Goodluck Jonathan bin wan remove di same fuel subsidy wey President Bola Tinubu goment don remove now, but dat time Nigerians protest against am for days, especially for Lagos state.

Dem get to reverse di petrol subsidy removal and listen to di pipo.

Anoda protest wey nearly succeed na di Endsars sake of say goment dissolve Sars, but di katakata wey join spoil evritin.

BBC Pidgin follow Political Analyst Sani Bala tok about dis protest issue and how successful e don be.

Oga Bala tell BBC Pidgin say protest na di right of evri citizen but Nigeria own dey always get K-leg sake of different reasons.

“Any democratic elected pesin suppose listen to di pipo, but for Nigeria case e depend on di politicians and dia political will.

Sometimes dem go listen and sometimes dem no go listen, we dey hope say goment go listen to di protesters dis time.

Oga Bala add say protests and strike no be di only ways wey citizens or pipo wey dey para fit use to tell di authorities wetin dem want.

Im explain say “protests for Nigeria dey fail sake of say sometimes politicians and jaguda pipo dey hijack am”

“Some of di civil servant dey join hand to destroy dis kontri, politicians too dey take advantage of dis kain protests”

Oga Bala make reference to di kasala wey happun during di Endsars protest for 2020 wia im allege say “dem burn over 200 houses, dem destroy cars and properties too”

“For 1991 one protest happun for Kano wey dem destroy properties and pipo also die, dis no be wetin dey expected from civilian protests.” Im explain.

Oga Bala say di solution to protests na to end bad leaderhip, sake of say if di leadership good no need for protests.

E advice Nigerians to do di following to avoid protests

Vote di right pipo into power.

Make good pipo wey fit lead well try join politics no be to stay one place dey complain.

All Civil servants fit agree to stay for house , no go work, dis na anoda way of protest.

Di public too fit do ‘sit at home’ na anoda type of protest be dat.

Make we stop to attend funerals, all di ceremonies wey dis politicians dey do to show our anger.

Make we also stop to collect money and gifts from dia hands, some pipo go balance for politician house dey wait for am to collect small small money, if you collect dos money how dem wan take know say una dey vex for di goment and leadership. Im tok.

Most wanted: Police arrest kidnap kingpin dem accuse of terrorising FCT and environs

Tags: NIGERIAProtest
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version