• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Pressure on goment over crash of newly imported train for Ghana – wetin we know about

Sisi Eko by Sisi Eko
April 23, 2024
in News, World
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Days afta one train wey Ghana import from Poland crash during di test run, goment don tok say di manufacturer go fix di damaged parts within di next three to four weeks.

Railways development minister, John Peter Amewu explain say “di electronic and mechanics system wit di engine still dey intact, na only di fenders damage.”

Engineers from Poland don assess di train wia dem dey order di damaged parts to fix am.

Di train wey dem import na part of di goment plan to boost rail transport for di kontri.

Goment plan say dem go buy up to twelve trains wia dem go use for di new Tema-Mpakadan standard-gauge railway line.

Di railways development authority tok say di trains go transport passengers from Mpakadan through Kpong, Juapong, Doryumu all di way to Tema port.

Sabi pipo explain say congestion for di kontri roads for Accra affect pipo dia lives and dia work.

Na so a proper railway system go fit help to reduce di congestion and traffic wahala.

Goment as a result construct di Tema-Mpakadan railway line wey be 97 km, to help di movement of goods and pipo along di Eastern corridor of di kontri.

Di line na part of a “planned 1000 km Ghana – Burkina Faso, wia go connect Ouagadougou to di Port for Tema.”

For 3 April, di railways ministry announce say one of di diesel multiple units (DMU) for di 100 km Tema-Mpakadan railway line don arrive from Poland.

Di ministry add say dem “go assemble di train wey dem go do test runs bifor im go dey ready for commercial operation.”

Na so on 18 April, di test run happun wia di train crash.

One statement from di railways ministry tok say di incident happun as di train negotiate a curve wey im crash into one truck wey park on top of di rail line.”

“Despite say dem apply emergency brake, di train neva stop bifor im collide wit di Hyundai truck,” di statement add.

According to di ministry, nobody hurt, wia pesin no dey inside di truck wia park for di rail line.

Dem tok say dem report di mata to di police as dem begin to dey investigate di mata.

Some pipo start to dey bash di goment say dem do shoddy job for di railway track but di minister, John Peter Amewu say im dey suspect sabotage.

Police arrest driver of di truck

Afta police don arrest di driver of di truck wey park for di rail line, dem put am bifor court.

Within twenty four hours, di Juapon Circuit court sentence 41 year-old Abel Dzidotor to six months inside jail wit hard labour.

Abel don plead guilty to three counts of “careless and inconsiderate driving, unauthorized stopping and unlawful damage.”

Di court wey judge Prosper Dey-Love Gormashie don preside, also fine Abel GHC 1,200 ($90) for careless and inconsiderate driving.

Di state prosecutor tok for court say Abel don lerf di truck for di railway line, without consideration for oda riad users, wia lead to di accident.

Im add say afta di accident, di accused don run away but di police find am wey dem take am to court.

Afta di court jail Abel to six months, di police arrest four more pipo for dia role in di accident.

Dem don charge dem wit “abetment to unlawful damage.”

Di high court wia Justice Lydia Osei-Marfo dey preside, don remand dem into police custody as further investigation dey go on.

Railways minister John Peter Amewu tok for one interview wit local media say “di supplier, Pesa Bydgoszcz SA dey responsible for di repairs per di agreement wit Ghana goment.”

Im add say “engineers from Poland don assess di damage wey dem order di parts to fix di train.”

Oga John Peter Amewu explain say “we go get ownership for dis train only afta dem finish di test runs wey di suppliers transfer ownership to Ghana.”

Di minister add say “goment of Ghana go dey responsible for di train afta di kontri don make full payment, but dis neva happun yet.”

According to di minister, dis train na one of two wey di kontri don dey buy from Poland.

“Di second one go come by di end of July. Wey both trains dey cost about $16m, each na $8m.”

UNIPORT set panel to investigate lecturer wey appear inside sexual misconduct video

Tags: News
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version