• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

President Bola Tinubu, Delta state goment react to di killing of 15 sojas for Delta state

Sisi Eko by Sisi Eko
March 18, 2024
in News
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

President Bola Tinubu don give di Defence Headquarters and Chief of Defence Staff full authority to bring to justice pipo wey dey responsible for di tragic killing of officers and sojas for Delta state.

Di Nigerian leader for statement say those wey commit di crime no go, go unpunished.

Di incident happun on Thursday, 14 March wen some community youths ambush sojas wey bin dey respond to one crisis between Okhuama and Okoloba communities for Delta state.

“Di military high command don already dey respond to dis incident. Di cowardly offenders wey dey responsible for dis heinous crimes go dey punished.” President Tinubu tok.

One Commanding Officer, two Majors, one Captain, 12 sojas and one civilian die for di attack.

Di Delta state govnor Sheriff Oborevwori don react to di killing of officers and sojas wey dey attached to 63 Brigade for Okuama community, Ughelli South Local Government Area of di state.

Govnor Oborevwori condemn di killings and promise to take all measures necessary to fish out all those wey dey behind di attack and ensure say dem face full wrath of di law.

E also tok sorry to di military and di families of officers and sojas wey die for di attack.

Chief of Defence Staff Christopher order investigation into di death of di troops

On Saturday, di Nigerian military bin confam di tragic killing of four of dia senior officers plus 12 sojas for Delta state.

For one statement wey di Nigeria Defence release on X (former Twitter), di troops bin meet dia untimely death as dem respond to one distress call afta di communal crisis between Okuama and Okoloba communities for di state.

According to di statement wey di Acting Director, Defence Information, Tukur Gusau issue, e say some community youths surround and kill di military personnel wey bin dey on peace mission go Okuoma community for Bomadi Local Government Area of Delta state.

Di sojas wey die for di attack include di team commanding officer, two majors, one captain and 12 sojas.

Meanwhile, di Chief of Defence Staff Christopher Musa don order immediate investigation into di tragic incident.

E also order for di arrest of everyone wey get hand for di terrible crime wey happun on Thursday, 14 March.

Di military say dem don arrest some pipo and steps dey in place to expose di motive behind di attack.

Reactions trail di killing of military personnel for Delta state

Di senator wey dey represent Delta North for di National Assembly, Ned Nwoko don give assurance say those wey dey responsible for di death of di sixteen sojas go dey identified and brought to justice.

For statement e release on X, oga Nwoko advise all parties wey dey involved to maintain calm and make dem no retaliate as dat fit worsen di problem.

E add say male authorities cary out thorough investigation into di incident and

“Make both state and federal goments quickly setup an all-inclusive panel to investigate di underlying causes of di crisis between di two communities, di reason for military intervention, plus di resulting casualties on both sides.”

Former Nigeria vice president Atiku Abubakar for im reaction to di killing, urge military authorities to exercise restraints for dia response.

Ban of bread wey no get label, reduced petrol sale – odd steps wey Zamfara goment take to reduce banditary

Tags: Delta StatePresident Bola Ahmed Tinubu
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version