Site icon ilenkogossipparrot

Plane wey carry Malawi vice president don miss

One military aircraft wey carry Malawi vice president Saulos Chilima don miss wey don make authorities begin search for am, di kontri Information and Civic Education Minister Moses Kunkuyu tok.

Di Malawi Defense Force say di aircraft “go off di radar” afta e leave di kontri capital, Lilongwe, on Monday.

Na Malawi Defence Forces get di plane and di commander of di Defence Force brief di kontri president afta di incident, di minister tok.

E add say e dey too early to tok di reason for di disappearance of di aircraft.

Oda passengers on di flight na some officials from di vice-president United Transformation Movement (UTM) party.

Di president order search and rescue operation afta aviation officials say dem no fit contact di aircraft.

Di vice president suppose land for Mzuzu International Airport around 11 dis morning but dem neva see di plane till now

Malawi President Lazarus Chakwera cancel im scheduled flight to di Bahamas afta e hear di tori.

Di vice president bin dey travel to represent di goment for di burial of one former cabinet minister, Ralph Kasambara wey die three days ago.

“Di public go dey updated of any development on di situation as we dey establish di facts,” di president office tok.

Di reason for di plane disappearance neva dey known, General Valentino Phiri tell Oga Chakwera.

Bifor im political career, e hold key leadership roles in multinational companies like Unilever and Coca Cola.

Oga Chilima, wey im age na 51 years, don be vice-president of di southern African konttri since 2014.

E don marry wit two children.

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

Exit mobile version