• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

One month of mass abductions for Nigeria

Sisi Eko by Sisi Eko
March 21, 2024
in Nigeria
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di Nigerian Army don announce say dem successfully “stop kidnapping attempt” and stop16 victims wey dem wan gbab from one community for di troubled Kajuru area of Kaduna State, for di northwest of di kontri, on Sunday night.

But di same night, terrorists attack anoda community for Kajuru and carri dozens of pipo.

In di past two weeks, northern Nigeria don see at least six attacks leading to mass abductions.

Dis latest incident highlight how violent criminal gangs, suspected to get links wit di al-Qaeda-link Ansaru group, don increase dia activities for dis region.

Dis two weeks dey challenging for di Nigerian goment, wey dem don force to stretch dia security resources to try rescue hundreds of kidnapped victims. But still, dem neva rescue one victim.

Di rise in lawlessness show how armed criminal gangs dey outside to manipulate Nigerian security forces, wey dey behind.

Many don criticise authorities for not acting fast enough and therefore encouraging more violent incidents.

‘’Di goment no dey serious about protecting lives and property. Officials no dey put am on dia list of priorities. If dem dey serious, we for done see di changes. We for don see improvements in security,’’ Isa Sanusi, Amnesty International Nigeria Country Director, tell BBC News.

Di first abduction dis month happun on March 6 in di north-east Borno State. Suspected militants attack one small town and kidnap at least 200 pipo, mostly women and children, from one internally displaced persons camp while dem dey search for firewood.

Despite launching a “search and rescue operation”, di military fail to rescue pipo wey dem kidnap.

Di next day on March 7, gunmen kidnap around 300 students and teachers from one school in Kaduna. Di state goment later announce say 28 of di students bin escape from dia captors.

Inside one statement, UNICEF Representative for Nigeria, Cristian Munduatehe condemn di ‘’alarming frequency of such incidents across di kontri’’ saying e ‘’signal a crisis wey require immediate and determined action from all levels of goment and society.’’

On March 9, gunmen kidnap at least 15 students from anoda school for Nigeria northwestern Sokoto state for one early mor-mor raid.

Two days later, suspected bandits attack Kaduna State Kajuru local goment area again, abducting 61 pipo.

Di latest attacks also happun for Kajuru, wit more dan 100 pipo, including women and children, wey terrorists take away.

Assurances by President Bola Tinubu to empower di armed forces to tackle insecurity don dey unda close scrutiny in di light of dis mass abductions. Despite repeated requests by di BBC, officials don fail to comment on dia plans to tackle di growing trend of abductions.

E neva clear why we bin get increase in kidnappings recently, but reports bin dey in di past wia women wey dem abduct dey forced to cook for dia captors.

Gunmen don ask for ransoms to release students wey dem kidnap earlier dis month, but di authorities insist say dem no go pay any money. Kidnapping for ransom dey common in Nigeria, but paying ransom dey illegal.

How much Chief Justice of Nigeria dey earn wit oda judges and wetin e mean for di judiciary

Tags: Abduction
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version