• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News Politics

‘No struggle to liberate a kontri dey come easy’ – Labour Party chairman tok afta police release am

Sisi Eko by Sisi Eko
February 22, 2024
in Politics
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

National Chairman of Labour Party, Julius Abure don regain im freedom afta police release am on bail.

Labour Party confam im release for statement for dia social media platform X.

“Our National Chairman Barr. Julius Abure don dey released. For di struggle for our party and liberation of Nigeria from bad governance and police brutality, we go overcome,” Labour Party tok.

Dis dey come afta Police for Edo State, South-South Nigeria arrest di chairman of Labour Party, Dr Julius Abure.

Police arrest am for Benin City, di Edo State capital on Wednesday.

Photos and videos wey bin go viral show how police carry Abure put inside one car wit officers inside.

Afta Abure regain freedom, e tank evribodi for dia support and for im speech as e come out from police hand e tok say evri fight for freedom dey come wit persecution.

“No struggle to liberate a kontri dey come easy, many kontri’s for di world wia freedom fighters bin fight for di freedom of di pipo, di freedom fighters suffer injustice and persecution.

“Na wetin dey happun to me and my oda colleagues since afta di general election. Afta di general election dem don try to cause katakata for di party, dem try to bring false accusation against us, dem bin don also tok about forgery, wen e no work dem bring embezzlement come.

“Anybodi wey no dey happy wit di party dem go go ginger dem to write petition against us, but di irony be say at di end of di day dem go discover say all di allegations against us no be true.” Abure explain.

Di Labour Party chairman also narrate how dem take arrest im and im colleagues on Wednesday for Benin City.

“Yesterday wen we dey make arrangement for di govnorship primaries, di police swamp on us, arrest ova wetin I no go like discuss now sake of say investigation still dey go on.

“I no go wan pre-empt dem, but I gatz state clearly say afta several interventions dem don release me on bail,” e tok.

Local media bin report say tok-tok persin for Nigeria Police Force Zone 5, Tijani Momoh, confam im arrest on Wednesday.

E neva clear why police arrest am till now as neither police, di Labour party nor Abure team don tok anytin about di arrest.

But reports from local media on Wednesday tok say di arrest of di Labour Party national chairman na on top allegations of attempted murder plus oda charges.

National tok-tok pesin for Labour Party Obiora Ifoh bin also confam di arrest of Abure for statement.

E tok say dem also arrest di Edo State chairman of di party, Kelly Ogbaloi.

Im say di Labour Party on Tuesday bin get veri successful delegate election for Benin ahead of di party Primaries wey go happun on Friday.

Ifoh allege say di arrest of di party officials na in connection to one protest letter wey one of di expelled member of di party loyal to Lamidi Apapa camp write.

Im allege say di arrest na to frustrate di primary process and possibly interrupt di party participation for di govnorship election.

“Di Deputy National Chairman of di Party, Dr. Ayo Olurunfemi for one video post tok say no form of intimidation from di highest quarters go stop di party from concluding di process wey go lead to di emergence of di Labour Party goment for di state,”

Dr Julius Abure wey be di National chairman of di party don dey face different problems for di party since.

Di latest na afta dem suspend di National Treasurer, Oluchi Opara, wey sama accuse for Abure head say e forgery and tiff di party money wey dem get during di 2023 presidential election.

Abure and di party bin don deny di allegations but di suspended National Treasurer Oluchi Opara dey insist say Abure must account for all di donations di party bin get during di elections both in dollars and naira.

Labour Party suspend dia National Treasurer, Oluchi Opara for six months last week.

Di suspension na sake of di contrary allegations of abuse wey Opara put against di leadership of di party.

Tori be say di pary bin get only N1.2 billion from donation from members and forms wey dem sell to some aspirants for di 2023 election.

Labour party allege say na di same pipo wey use factional chairman Apapa Lamidi dey sponsor Opara to distract di party.

Meanwhile Nigerians don begin react about di news of di arrest of Dr. Julius Abure.

While some dey ask question s why dem go arrest am like dat, odas dey wonder why a party like Labour go getv dis kain issue.

Govnorship election for Edo state go happun for September 2024, and di build-up to di process don start wit party primaries and election of flag bearers.

Edo state na one of di states wey dey do off-cycle elections for Nigeria.

Hunger, high cost of living dey force Nigerians to protest

Tags: Labour Party
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
People

Di Ghana 2024 elections registration wey dey target 623,000 new voters

May 9, 2024
People

New constitution dey threaten election of President Faure Gnassingbé wey im family don rule Togo for over 57 years

April 29, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version