• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

Sisi Eko by Sisi Eko
June 12, 2024
in Nigeria
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

President Bola Tinubu address Nigerians on June 12 Democracy Day, to mark di kontri 25 years of uninterrupted democracy.

For im speech, di president touch on some of di issues wey dey face di Nigerian pipo.

Di president tuale some of di many Nigerians wey contribute to di struggle.

President Tinubu also honour di media for dia work during di struggle for democracy.

According to di president, Nigeria gatz continue wit democracy no mata how complicated e fit be.

Dose President Tinubu celebrate celebrate include MKO Abiola, winner of di June 12, 1993 presidential election and im wife Kudirat, General Shehu Musa Yar’Adua and Pa Alfred Rewane, plus odas wey die for di sake of di struggle.

E celebrate some of di founding fathers of Nigeria democracy wey include Anthony Enahoro, Abraham Adesanya, Commodore Dan Suleiman, Arthur Nwankwo, Chukwuemeka Ezeife, Admiral Ndubuisi Kanu, Frank Kokori, Bola Ige, Adekunle Ajasin, and plenty odas from different parts of di kontri.

Di president troway salute give di kontri men wey bin live on exile for at least six years sake of dia fight for di kontri to return to civilian rule.

Inside dis group na pipo like General Alani Akinrinade, Professor Bolaji Akinyemi, Professor Wole Soyinka, Ralph Obioha, and odas.

Tinubu also tuale im fellow National Democratic Coalition (NADECO) members wey bin remain for Nigeria to continue di fight for democracy.

E no also forget to hail Nigeria tori pipo for dia contribution to di struggle for di kontri demcocracy.

Highlights of President Tinubu address

Minimum wage

President Tinubu tok say im don negotiate wit organised labour on a new national minimum wage.

E say im administration go soon send executive bill to di National Assembly to stipulate wetin don dey agreed upon as part of of Nigerian law for di next five years or less.

“In di face of labour call for a national strike, we bin no seek to oppress or crack down on di workers as a dictatorial goment go don do. We choose di path of cooperation ova kasala,” Tinubu tok.

“Di president tok say im take on “dis vital task witout fear or favour and I commit mysef to dis work until we don build a Nigeria wia no man dey oppressed.”

Rights, freedoms, and liberties of Nigerians

President Tinubu tok say as leader of di nation, im vow to do im utmost best to protect di rights, freedoms, and liberties of Nigerian citizens.

“Even more dan dat, I pledge to do whatever dey necessary to cement democracy as our way of life.

“Although di challenges dey steep and multiple, I dey grateful to lead Nigeria at dis moment in her history and point in her democratic journey.”

Economy

President Tinubu for im speech tok say im go use di opportunity of Democracy to take defend di economy of Nigeria.

Im add say Nigeria economy no too balance sake of say di past goment don depend ontop oil too much.

“We gatz commit oursef to di realisation of economic democracy.”

“I feel your pains but I go continue to refine di economy. Our economy dey unbalanced becos say e dey built on oil exploration.”

Pipo wey wan destroy democracy

President Tinubu remind Nigerians say even though democracy fit dey complicated sometimes, na still di best choice for Nigeria.

“As Nigerians, we gatz remind oursef say no mata how complicated democracy dey, na di best form of governance in di long run,” im tok. E add say make di pipo shine dia eyes as e get some pipo wey wan destroy democracy.

E say no be like say dis pipo wan make tins beta o, but dem wan scata democracy so dem go fit control anybody wey no dey for dia gang.

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

Tags: Minimum wagePresident Bola Ahmed Tinubu
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Lifestyle

‘My 17-year-old son die within six hours afta dem begin blackmail am with im fotos’

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version