Site icon ilenkogossipparrot

Nasarawa state university rice distribution turn deadly afta at least three pipo die for stampede

Reports say at least two pipo don die for Nasarawa State University while odas injure for one stampede wey happun for one rice distribution event.

Tori be say yawa gas wen goment organise one rice distribution event for di NSU students.

But di crowd too much and pipo break through di barricades to get di food and na dia stampede happun.

Video show di moment di crowd overpower security and push through di gate to try access di place dem keep di bags of grains.

One student of di school tell BBC Pidgin say di venue for di rice distribution na di ‘Convocation Ground’

Anoda student di tori too say last week, dem distribute di rice for students of Federal University Lafia, and dis week, na di turn of im school, Nasarawa State University, Keffi.

E say di number of students wey gada for di convocation square wia dem dey share di rice plenty more dan di quantity of rice wey dem dey share, so e cause stampede.

Pipo push down di gate for di arena as dem dey struggle to get di rice.

Di state goment don also confam di incident.

Inside statement, Govnor Abdullahi Sule say im receive with shock di news of di stampede for di Nasarawa State University, Keffi on Friday morning.

“According to reports, di sad incident happun wen suspected hoodlums and some misguided students force dia way into di school convocation ground to gbab di rice dem bin keep for di venue wey dey meant for distribution as palliatives to students.

Dis misfortune happun only hours before di scheduled official flag.” E tok.

Di plan na to distribute rice and N5000 cash each to students in all tertiary institutions for di state.

Dem don already do am for Federal University, Lafia, Isa Mustapha Agwai Polytechnic,Lafia, College of Agriculture, Science and Technology, Lafia, the School of Nursing, Lafia as well as the College of Education, Akwanga.

Odas na di Federal Polytechnic, Nassarawa and the College of health Technology, Keffi.

Di govnor say di tragic death of di two students for di institution happun inside a needless stampede wey dey motivated by crime.

Im don direct di authorities of di school and security agencies to commence immediate investigation into di incident to find out those wey dey behind am.

Anas Ramalan, wey be former President of Nasarawa State Students Association for di school tell BBC Pidgin say di incident don show di level of hunger and poverty wey di students dey face.

“Dis don show di goment di level of hunger wey di students and pipo in general dey face. Just imagine as pipo die just bicos of palliatives. E dey very sad,” Ramalan tok.

“Goment suppose reach out to di families of di students wey die and compensate dem.”

Ramalan tok say na di unnecessary media hype wey di goment do on top di palliatives wey dem wan share na im make students troop out in large numbers, but di quantity of rice wey goment bring true true no reach di number of students wey come out.

Anoda student, Raphael, tell BBC Pidgin say some students bin don dey di convocation ground – wey be di venue for di palliative sharing – since 4am on Friday.

E tok say as di stampede happen some students no come get di rice at all while some carry up to five bags.

One month of mass abductions for Nigeria

Exit mobile version