Former principal secretary to former governor of anambra Willie Obiano wey be Willie Nwokoye don give advice to people wey too dey like chop for outside or party.
Hin enta hin Facebook page on Sunday 3rd September dey tell people say if dem wan chop for outside say make dem chop chop their food wella before dem swallow am enta belle.
He Dey advice dem coz of wetin hin see for hin food for d burial wey hin go on Saturday. He tok say e remain small hin go swallow iron as he Dey chop swallow and egusi soup for one burial.

Hin con post picture of the kyn thing wey hin see con drop d whole tori for hin page.
