Site icon ilenkogossipparrot

Naija lady don yarn us wetin make her marriage end. (Video)

One young hanty don enta intanet dey cry after her boyfriend serve am breakfast.

She con tok say d man leave am go follow high school pikin wey get yansh pass am.

For video wey she post for tiktok, e show wer d hanty dey cry as she Dey remember her relationship wey don scata

She con dey yarn say after she don do many things say make d relationship work hin con dump am follow person wey she senior.

Say na d girl shape wey d boyfriend like especially her yansh. (Wahala o)

”Relationship wey I don suffer build, pikin wey jus comot secondary school don use yansh carry am” na so she take write am for video

Watch video for down:

https://ilenkogossipparrot.com/wp-content/uploads/2023/08/trim.9D422E4F-0A6D-4A76-BAAC-69C8F45B903D.mov


For d video wey she share for TikTok, e show say d boyfriend don already propose give her better ring (the one wey chop breakfast). D whole jolijoli con turn to kasala as d new fiance con serve am beta breakfast.

As she take dey broadcast say she don Dey engaged na so she take use d same hand tell people say d fiancé don end d marriage.

https://www.yabaleftonline.ng/nigerian-lady-weeps-profusely-boyfriend-dumpedrecent-secondary-school-graduate-video/embed/#?secret=rrO2Aj5LOb

Exit mobile version