Nollywood actress wey people sabi wella wey her name na Bimbo Ademoye don share her tori of her first betrayal wey she don get for one interview.
As she Dey follow d media person Hauwa Magaji tok, the 32 year old actress tok say her experience for betrayal happen when her mama been leave am when she Dey 2 years.
She been open up d whole mata with her mama as she Dey answer question for d interview say why e be say she Dey always celebrate only her papa.

Bimbo con add say she dey take care of her mama make relationship try dey between them.
Na so she take tok am:
“My mama still Dey alive and she no dey live far from my side. We jus no be paddie. My mama been leave me when I Dey small na how I take get my first betrayal. I don try say make I try build some kyn relationship with am. Laidis now I jus dey do wetin pikin dey do for hin mama. I Dey pay her rent and give am money, na d only thing wey dey between us. I no get problem with am. I Dey happy say we no too dey close for my mental health and for myself.”