Site icon ilenkogossipparrot

Most wanted: Police arrest kidnap kingpin dem accuse of terrorising FCT and environs

Operatives of di FCT Police Command say dem don arrest one Samaila Wakili Fafa A.K.A Habu Ibrahim, di second most wanted kidnap kingpin, wey bin don dey on dia wanted list for a long time now.

Police tok-tok pesin SP Josephine Adeh for statement tok say dem gbab Habu Ibrahim on 24 February around 7:00 PM.

FCT Minister Nyesom Wike bin place 20 million naira bounty on Samaila Wakili Fafa and im second dia head wey bin dey follow terrorise di city.

Police say di arrest na base on one ogbonge intelligence, wey make dem storm Sardauna Forest, Toto, Nasarawa State and arrest am.

Police allege say Habu Ibrahim na kidnap kingpin wey don dey wanted list of di Command for long time.

Dem say di suspect bin confess say na im gang dey carry out kidnappings for FCT and im surroundings.

E say na dem also kidnap one Barr. Chris Agidy, legal aid to Senator. Ned Nwoko and Mr Sunday Yahaya Zakwai, wey be district head of Ketti Village wey dem later kill.

Police add say Samaila Wakili further lead police operatives to wia di remains of Barr. Chris Agidy dey.

Authorities don recover and deposit di bodi for Gwagwalada General Hospital.

Investigation still dey go on, police add for di statement.

For early February, FCT minster Nyesom Wike for one meeting wit di police bin announce one bounty ontop di two most wanted bandits.

E bin declare 20 million naira ontop Dahiru Adamu and Abu Ibrahim, sake of tori of how dem dey terrorize Abuja.

Di Anti-Kidnapping Unit of di Federal Capital Territory Police Command bin don first arrest Saidu Abdulkadir aka Dahiru Adamu, Habu Ibrahim second and di most wanted kidnapper.

Abdulkadir arrest happun wen security operatives raid two kidnappers camps for border of Nasarawa and Abuja for 15 February for early mor-mor 12:00am.

Tori of coup plot for Nigeria na lie – wetin be di Guards Brigade wey Defence Headquarters tok about

Exit mobile version