ilenkogossipparrot

Make everybody getat I no dey do again- Wizkid

Award winning singer, Ayo Balogun wey people sabi as Wizkid para as women rush gather enter hin message tok say dem wan do feem with am.

D reason be say he been tok for hin Instagram tori say he wan dey inside feem wey he go dey kiss kiss women for feem na why people con rush am.

He add say he wan dey for feem wey he go dey shoot gun and Dey kiss women.

Like play like play women con rush enter hin message con dey tell am say make he choose dem say dem wan kiss am for feem.

Na so he con vex con para for dem say na him go choose who he wan kiss for feem o say make dem pack one side.

Court say make dem keep Godwin Emefiele for Kuje prison

Exit mobile version