• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News

Latest on Japan earthquake wey don kill ova 40 pipo so far

Sisi Eko by Sisi Eko
January 2, 2024
in News, World
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Di number of pipo wey don die for one powerful earthquake wey cause houses to collapse plus make goment give tsunami warning, don increase to 48 for Japan.

Officials for Ishikawa disaster headquarters wey confam dis report say di number fit increase more as rescue effort dey continue.

Around 1,000 rescuers dey search for pipo wey dem tink say fit dey trapped inside collapsed buildings.

Japan Prime Minister, Fumio Kishida, say di earthquake cause plenty casualties and dem dey “race against time” to rescue survivors.

“We have to race against time to search for and rescue victims of di disaster,” PM Kishida tok afta one disaster response meeting.

“We don confam very extensive damage, including plenty casualties, building collapses and fires,” im say, come add say rescuers dey find am difficult to reach di northern tip of di Noto peninsula.

Some 33,000 households dey face freezing temperatures for night sake of lack of electricity. Many cities also dey without running water.

Japanese military dey give pipo supplies wey include food, water and blankets for pipo wey need to leave dia house.

Earlier, goment bin give warning say one major tsunami fit happun afta one 7.6 magnitude earthquake bin strike di central area.

Now, dem don lift all di tsunami advise along di Sea of Japan, meaning say dem no longer get risk say tsunami go happun.

Di earthquake damage 1,000 houses for di coastal town of Suzu, wit mayor, Masuhiro Izumiya, describing di situation afta as “catastrophic”, according to one Reuters report.

Suzu, wey get just 5,000 households, dey located near di epicentre of di New Year Day quake.

Di quake also damage one temple and several graves for di town, local tori pipo NHK report.

Key points from President Tinubu New Year message to Nigerians

Tags: JapanNews
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version