Popular media personality, Bolanle Olukanni don enta sociomedium dey yarn us how she take dey reason kpanshing (sex) for love relationship.
Na so she con drop the reason and how kpanshing Dey take spoil things for relationship.

For the tweet wey she write, she tok say kpanshing dey stress relationship and e Dey make people make dem no see things as so dem be and even sef, dem go dey make yeye decisions.
She no gree say kpanshing na just normal thing between man and woman but na something wey man and woman go do make their relationship con dey deep and strong.
Even as young people dey tok say kpansh na just kpansh, Bolanle no gree concur to wetin dem tok as she say kpansh pass touching body.
She con add say people wey suppose dey kpansh suppose get better close relationship wey dem no dey use play. She con share her own experience say as she no gree knack, e Dey make am make better decisions for her relationship.


Make una see wetin Davido tell BBNaija winner Phyna wey cos gbasgbos for intanet