Site icon ilenkogossipparrot

Key points from President Tinubu New Year message to Nigerians

Nigeria President Bola Tinubu don wish kontri pipo Happy New Year for inside one early mor-mor national broadcast on Monday.

For di national broadcast, e also highlight im journey as president so far.

“Though di past year na a very challenging one, e dey eventful in so many ways. For our kontri, na a transition year wey see a peaceful, orderly and successful transfer of power from one administration to anoda, marking yet anoda remarkable step in our 24 years of unbroken democracy.” E tok.

Everything I don do in office, every decision I don take and every trip I make outside di shores of our land, since I assume office on 29 May 2023, I do am in di best interest of our kontri.” E tok.

Di president commit to making Nigeria, destiny of choice for local and foreign investment as e promise say im administration go work diligently to make sure say every Nigerian feel di impact of dia goment.

“I take oath to serve una, and I go give my best at all times.”

E also extend a call to political opponents in di last 2023 presidential elections to come togeda and work with am for di betterment of di kontri.

Some of di key points from di broadcast na wetin di president tok on fuel subisdy, di foreign exchange system, security, steady power, food supply and affordability, fiscal and tax policy reforms and implementation of a new minimum wage for workers.

On Fuel Subsidy removal and Forex mata

Di president touch on di issue of di fuel subsidy removal and changes to di foreign exchange system.

“Over di past seven months of our administration, I don take some difficult and yet necessary decisions to save our kontri from fiscal catastrophe. One of dem na decision to remove fuel subsidy wey bin don become an unsustainable financial burden on our kontri for more dan four decades.

Anoda na di removal of di chokehold of few people on our foreign exchange system wey benefit only di rich and di most powerful among us.”

Di president agree say e know say di two decisions bring some discomfort to individuals, families and businesses but say di rough times no go last.

Security

On security, di president say although all di security problems neva dey solved, goment dey work hard to ensure safety of lives and property.

“Silently, we don work to free captives from abductors. While we no fit beat our chest yet say we don solve all di security problems, we dey work hard to ensure say we all get peace of mind in our homes, places of work and on di roads.

‘Steady electricity supply’

On power supply, di president highlight di progress made so far.

“Just dis past December during COP28 for Dubai, di German Chancellor, Olaf Scholz, and I agree and commit to a new deal to speed up di delivery of di Siemens Energy power project wey go ultimately deliver reliable supply of electricity to our homes and businesses under di Presidential Power Initiative wey begin for 2018.”

Di president add say oda power installation projects to strengthen di reliability of di transmission lines and optimise di integrity of di national grid dey on across di kontri.

“My administration recognise say no meaningful economic transformation fit happen without steady electricity supply. For 2024, we dey move a step further in our quest to restart local refining of petroleum products with Port Harcourt Refinery, and di Dangote Refinery wey go fully come on stream.” Di president add.

Food supply and affordability

On dis, di president say:

“To ensure constant food supply, security and affordability, we go step up our plan to cultivate 500,000 hectares of farmlands across di kontri to grow maize, rice, wheat, millet and oda staple crops.

We launch di dry season farming with 120,000 hectares of land for Jigawa State last November under our National Wheat Development Programme.”

Fiscal and tax policy reforms

Di president say im administration dey work to make business competitive for Nigeria and to attract investments come di kontri.

“For dis new year, we go race against time to ensure all di fiscal and tax policies reforms we need to put in place dey codified and simplified to ensure di business environment no destroy value.

On every foreign trip I don go, my message to investors and oda business pipo na say Nigeria dey ready and open for business. I no go hesitate to remove any obstacle on di path to making Nigeria a destination of choice for local and foreign investments.” Di president tok.

New minimum wage

On di new minimum wage for workers, di president say e go come into force dis year.

“We go work diligently to make sure every Nigerian feel di impact of dia government. Di economic aspirations and material well-being of di poor, di most vulnerable and di working pipo no go dey neglected.

Na in dis spirit we go implement a new national living wage for our industrious workers dis new year. No be only say na good economics to do am, na also di morally and politically correct tin to do.” E tok.

Slangs wey trend for social media and street for 2023

Exit mobile version