Site icon ilenkogossipparrot

Kenya president announce indefinite postponement of school resumption inside nationwide broadcast to address flood palava

Di president of Kenya Williams Ruto don announce further postponement of school children resumption for di kontri.

Di president tok dis for di national address wey im give for di state for di kontri capital, Nairobi.

According to President Ruto, schools for Kenya go dey closed till further notice.

“Di ministry of education dey directed to postpone di dates of reopening of all schools in di kontri for di second term until further notice”

Di Kenya ministry of education bin postpone di reopening of schools across di kontri due to di flooding.

Inside one statement for April, Cabinet Secretary of di ministry Ezekiel Machogu say dem go postpone di second term by one week due to di heavy rain, wey don affect some schools in di kontri.

Primary and secondary schools wey suppose open on Monday, 6 May 2024 don dey further postponed.

Oda tins President Ruto tok for di national address

President Ruto tok say di floods wey sweep through Kenya don claim about 210 life for di kontri.

“di weight of di tragic event wey happun in recent weeks don test di nation resilience for challenges. Persistent rain don cause devastating floods wey don claim 210 life as of today,” Ruto tok.

Di president tok how di flood don case serious wahala for di kontri.

“E don also cause injuries and cause katakata for our infrastructure and life of di pipo. No corner of di kontri escape, school resumption dey postponed and transportation don become challenges sake of di floods.”

Relocation plans and IDP camps

President Ruto also add say make local authorities begin di reconstruction of schools wey di heavy rainfall and floods don destroy since March.

Also, im tok say make dem begin di evacuation of pipo wey dey live for risk flooding areas and dem don serve relocation notice to pipo.

“Di kenya army, police and oda security agencies dey directed to deploy operations to safeguard pipo and evacuate dose wey dey for high risk area.”

President Ruto say dem go relocate pipo comot from di dams wey dey pose threat to di kontri.

“Goment don map out 178 dams and water reservoir within private and public county. Areas wit landslide dey mapped as high risk and pipo gatz dey relocated.”

Di president add say dem “don give relocation notices to pipo wey dey live for settlement, river, streams and oda water places”.

According to di Kenya president, di goment don set up 115 internally displaced pesin camps across di kontri and e go host about 27,587 pipo wey dey affected by di flood.

Foods and shelters for Kenyans

Plenti affected pipo no see food to chop and no place to live in. Kenyan goment say dem don plan how to provide food and non-food essentials for dose wey di floods really affect.

“Di goment don put in place plans to provide shelters, foods and non-food essential supply to support every affected pesin. Goment don partner to make food available for pipo wey dey affected.”

President Ruto say dem neva see di last of dis period as di situation dey expected to escalate and report say di rain go continue in high volume for di rest of dis month and possibly afta.

“Di climate agency don issue warning say Kenya fit face dia first eva cyclone wey fit hit anytime.”

“E go cause heavy rain, strong wind and dangerous waves wey fit affect di kontri. And our kontri gatz act fast to save life and properties,” Ruto tok for di state address.

How weeks of rain for Kenya don lead to deaths, floods plus affect school resumption

Rain don dey fall for di past six weeks for Nairobi, and di impact na ogbonge one.

So far, ova 180 pipo don die for di early part of di floods, sake of di heavy rains and floods.

Rivers and soakaways don overflow, roads don become waterways and homes don destroy.

Flooding for Nairobi dey unusual but how big dis year own dey don expose longer term problem wit di way di city don develop.

“You no fit contain nature. e no fit work like dat,” Prof Alfred Omenya, one urban planning and environment expert, tell di BBC.

E tok say plenti of di city sit down on top di Nairobi River floodplain, wey cut through di capital. Some oda rivers and streams also dey flow through Nairobi.

Properly developed drainage system fit cope, but as di city don grow ova di last century from 100,000 residents to today 4.5 million, di infrastructure neva keep up.

Compounding di problem na say less dan half of di residents dey connected to one sewage system. For slum areas, open sewers dey common, wey dey overflow wen e flood.

Wetin be Turkey own for di Israel-Hamas war and why dem stop business wit Israel ?

Exit mobile version