As una know say muslim pipu no dey use any kyn tin take play, na so Kano hisbah board take carry two men wey b say dem wan marry deir sef put for kirikiri. D hisbah commandant Sheikh Aminu bin open deir yansh for public wen hin bin dey discuss newsmen for saturday 22 july 2023.
E con b say d kyn pipu wey dem dey tok about con deny am say no b marriage dem bin wan do say na birthday party. Sheikh con even add say e get one video wey d men Khalifa and Abubakar dey try kiss for d kyn party.

khalifa con dey explain say na hin bin arrange d whole party and hin friend Abubakar bin dey use play play give am cake for hin mouth.
Sheikh don confam say d two of dem don alredy dey cell as investigation dey occur.
Omo dis kyn mata wear skirt o. As e b so we no know weda na true d men dey tok abi na lie.
https://www.yabaleftonline.ng/kano-hisbah-arrests-two-young-men-alleged-same-marriage/
Make una no forget to dey follow our social media page @ilenkodegossipparrot for IG and @IlenkoGparrot for Twitter.