Site icon ilenkogossipparrot

ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

Prince Ikenna wey pipu sabi as IceSleek or Industry baby be one of naija star wey get beta futur for music industry. Dis Eko brot up singer and songwriter wey hin music dey unique pass oda singers and pipu dey enjoy hear no mata d kyn type of song wey he sing.
Hin Dey unda Tuffgig Music Empïre wey deir Oga kpatakpata for producer be Hardy Jimbaz.

IceSleek wey drop hin last jam “Calm Down” wey he follow sing with American Renowned reggae all girls band, Worl-A-Girl, con change as pipu dey see music before, wey con make am drop dis ogbonge jam wey hin call “NO GREE”.

D song NO GREE bin come from d kyn tins wey don sup for hin life as tins no gree balance, d story sef no dey different from d kyn shege pipu dey face evriday.

D Afrobeats, Afro-pop infused genre and song no just Dey tok about hin beta tori wey hin dey tok but e get d kyn madd beat wey d gbedu get as e dey give ginger and fire for bodi.

Make una click d link wey dey for under, share and enjoy dis beta gbedu “NO GREE”.

Click here👇
https://linktr.ee/tuffgigicesleek?utm_source=linktree_admin_share

Why Supreme Court stop $3500 monthly salary to Ghana First Lady, wife of Vice President

Exit mobile version