Site icon ilenkogossipparrot

Icesleek a.k.a “Industry Baby”, d next big deal for naija music industry

Our afrobeat and afro fusion musician wey b Icesleek na fast rising naija artist wey hin grace for music dey skyrocket . Hin get oda names wey be industry baby and new kid for block.

Dis dark skin guy wey b ladies man as dem dey take cal am for hin new gbedu wey jus land HOLLA, go b one of d next rated big musician wey dey shele for naija and outside country.

Icesleek wey dey vibe dey promote d two new jam wey hin cal HOLLA and CALM DOWN for many place and even for oda music chanel afta tuffgig sign am as dis year start na better ginger.

Hin con dey yarn us d tins wey make am grow for music. Hin tok say e don see dey begin learn from musicians wey dey top so hin go improve. Dey ginger hinsef everyday say hin fit do well if hin work dey put hin head for game. Hin con add say prayer sef follow coz say music na spiritual and e dey epp am dey attached.

E neva reach two months afta hin first song drop since dem sign am, hin don already fire anoda gbedu with Worl-A-Girl con cal am Calm Down. Lai dis now dis reggae gbedu don full everywhere for Jamaica and even people wey dey outside country.

D fast growing star wey dey work 24/7 na person wey dey monitor hin rise and step.

Make una hear Icesleek Holla for down

https://linktr.ee/tuffgigicesleek?utm_source=linktree_admin_share

Exit mobile version