Site icon ilenkogossipparrot

How Supreme Court take decide govnorship election cases for 6 states

Di Supreme Court of Nigeria don begin give judgement for di govnorship election petitions wey political parties and candidates carry come.

Di Supreme court on 12 January bin don deliver judgements for di govnorship elections for seven states – di states na Kano, Bauchi, Zamfara, Ebonyi, Plateau, Abia and Cross River states.

Di first state dem settle na Delta state wia di court affirm di election of Sheriff Oborevwori as govnor of Delta state.

Di apex court throway di appeal of di All Progressives Congress candidate, Ovie Omo Agege

Court say dem follow and obey a substantial part to di electoral act.

Court say di appeal lack merit and di appellant dey unable to discharge di burden of proof wey dem place on am.

For di appeal wey di Social Democratic Party (SDP) candidate Kenneth Gbagi carry come dia dormot, di Supreme court for dia judgement say im score shikini 4,639 votes to come 5th for di election, but im still dey challenge di eligibility of di PDP and APC to participate for di election.

Supreme Court also strike out di appeal sake of lack of merit.

Di highest Court for Nigeria also dismiss di appeal of Labour Party and dia candidate, Ken Pella against di govnor of Delta state, Sheriff Oborevwori.

Court say di appeal lack merit too.

How Supreme Court judge oda state govnorship election petitions

Ogun state: Dapo Abiodun of Ogun State win for Supreme Court. Dis na afta di Supreme Court uphold di victory of Adedapo Abiodun of dị All Progressives Congress as govnor of Ogun state.

Di apex court dismiss di appeal of di candidate of di Peoples Democratic Party, Oladipupo Adebutu. Court tok say di appeal no get merit.

Justice Tijani Abubakar wey deliver di judgement tok say im gree wit di judgements of di two lower courts on di mata.

“Dis appeal dey unmeritorious, e deserve to dey dismissed, and I don dismiss am,” Justice Tijani tok.

Di appellants, Ladi Adebutu and di Peoples Democratic Party bin pray di apex court to compel di Independent National Electoral Commission (Inec) to conduct fresh elections for di 99 polling units wia dem bin allegedly cancel di elections.

Di Appeal Court, Lagos Division, for one split decision on November 24, 2023 bin affirm di re-election of Dapo Abiodun as di elected govnor of Ogun State.

Di majority judgment wey Justice Joseph Ikyegh bin deliver dismiss di appeal wey PDP and dia govnorship candidate, Oladipupo Adebutu bin file.

Nasarawa state: Supreme Court also confam Abdullahi Sule as di authentic govnor of Nasarawa State.

Abdullahi Sule of di All Progressives Congress (APC) and im opponent David Ombugadu of di Peoples Democratic Party bin dey go head to head.

Both of dem bin win for di Court of Appeal and di election petitions tribunal.

For di Supreme court judgement wey Justice Kudirat Kekere-Ekun deliver, she tok say di judgement of di Appeal Court make sense and she uphold am.

Di oda four Justices also gree wit di lead judgement and all of dem dismiss di appeal wey David Ombugadu file.

Ombugadu bin dey challenge di victory of Abdullahi Sule for tribunal as e allege say Inec bin reduce im total votes.

Di tribunal agree wit am come rule say na im win di election true true, no bi Sule as Inec declare.

But di Court of Appeal reverse di tribunal judgement and return victory to govnor Sule.

Gombe state: Di Supreme Court uphold di judgments of di lower courts wey affirm di election of govnor Inuwa Yahaya of Gombe state.

Jibrin Barde of di Peoples Democratic Party, PDP bin dey contest di outcome of di election.

Justice Kudirat Kekere-Ekun wey deliver di Supreme court judgement on Friday, tok say di appeal wey Jibrin Barde of di PDP file no get merit.

Barde bin allege say electoral mago-mago and irregularities bin happun for nine out of di 11 Local goment areas of di state during di 18 March election.

But both di Election Petition Tribunal and Court of Appeal bin strike out im petition sake of lack of merit.

Kebbi state: Di Supreme Court also confam di election of di govnor of Kebbi state, Nasir Idris of di All Progressives Congress (APC).

For di Supreme court judgement, court hold say di appeal lack merit and dem subsequently dismiss am.

Di apex court also dismiss all oda appeals wey parties and candidates file.

Di Inec bin declare di election wey happun for Kebbi state inconclusive. Dem declare am inconclusive sake of cancellation and over voting for some Local Goment Areas.

Inec on 15 April bin conduct supplementary election and Nasir Idris of di All Progressives Congress, score 409,225 votes to beat Aminu Bande of di Peoples Democratic Party wey get 360,940 votes.

Aminu Bande bin drag Nasir Idris go di Election Petitions Tribunal wia e allege say over-voting bin happun for some polling units and Nasir Idris qualify to contest di election.

Di tribunal bin deduct 1,735 votes from APC, dem also remove 900 votes from di PDP results too. But di votes wey dem remove no effect on di election of Idris.

Kaduna state: Di Supreme Court also affirm di election of Uba Sani as Kaduna State govnor.

Di highest court for Nigeria dismiss di appeal wey di Peoples Democratic Party, and dia govnorship candidate, Mohammed Ashiru Isa carry come dia dormot sake of lack of merit.

Di Court of Appeal for Abuja, on Friday, 24 November bin affirm di election of Governor Uba Sani of Kaduna State.

Di three-member panel, for dia unanimous judgement, dismiss di five-ground appeal wey Isa Ashiru, of di Peoples Democratic Party (PDP) file.

Di Election Petition Tribunal for Kaduna state bin split dia decisions and dia conclusions on merit of di case and technicality.

Di Supreme bin don give judgement of eight states, di states na Kano, Abia, Cross River,, Ebonyi, Plateau, Lagos and Bauchi.

US court set to return stolen assets worth over ₦8.2billion to Nigeria

Exit mobile version