• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Celebrities

How celebrities turn up for actor Kunle Remi wedding

Sisi Eko by Sisi Eko
January 20, 2024
in Celebrities, Entertainment News
0 0
0
0
SHARES
4
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Nigerian celebrities gada to celebrate wit Oyekunle Oluwaremi Opeyemi wey pipo sabi as Kunle Remi as im dey marry im long time girl friend Boluwatiwi Oye for Lagos on Friday.

Di couple adore demselve wit orange and brown traditional attire as dem tie di knot traditionally.

Tori of dia engagement bin comot on 1 January wen Remi post foto of dia hands wit engagement ring on im official Instagram page.

Remi add caption for im instagram page say, “Tiwi, I don come to you humbly as G.O.A.T wit a goat… you dey ready to dance Ayamii ?”

During di traditional wedding, Nigeria billionaire Femi Otedola, Bisola Aiyeola, Bimbo Ademoye, Adeyemi Okanlawon, Layi Wasabi, among odas congratulate di couple and celebrate wit dem.

Also celebrities like Nnadi Akah, Mofe Duncan and Daniel Effiong wear Agbada to grace di occasion and support di groom wey dey beg for di hand of di bride in marriage.

Di couple hold dia church wedding early mor-mor on Saturday for Lagos.

Bimbo Ademoye, wey attend di wedding as groom friend, express her happiness for Remi and Tiwi on her Instagram page.

“My brother don dey hitched !!. Best man duties . I dey happy right now. Tank you God for such a beautiful day,” she bin write.

Kunle Remi na graduate of di New York Film Academy for Los Angeles.

For 2010, Kunle Remi win Gulder Ultimate Search competition and im feature for im first feem for 2011 title “Heavy Beauty”.

For 2021, Kunle co-host Gulder Ultimate Search.

Remi start im modelling career afta im win Gulder Ultimate Search and im don advertise for plenti local and international brands.

Kunle na di popular actor wey play di role of Saro for Ainkulapo wit im colleague Bimbo Ademoye as im wife for di award-winning movie.

Boluwatiwi Oye na graduate of Loyola University, Chicago.

She be di niece of Femi Otedola, wey make di billionaire her maternal uncle.

Femi Otedola and Boluwatiwi mama, Omotola Oye na di children of di former govnor of Lagos State, Michael Otedola and im wife Lady Doja Otedola.

Boluwatiwi na twin to Boluwatife Oye and dem come from Ekiti State for Nigeria.

Boluwatiwi Oye na daughter to Pastor Bimbola Oye and Omotola Oye.

Toladi Otedola wey be di bride cousin dey among her bridesmaid during di traditional wedding.

Boluwatiwi Oye describe her husband as pesin wey dey humble and love pipo genuinely.

She tok say im dey funny “ Im fit make me dey laugh, dey begin roll for ground wit di many voices and animations im dey use to tell me”.

How Supreme Court take decide govnorship election cases for 6 states

Tags: Entertainment NewsKunle RemiViral
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

created by photogrid
Celebrities

Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

May 8, 2024
Entertainment News

Who be Afronitaaa and Abigail di hearing impaired child dancer from Ghana wey impress judges for Britain’s Got Talent

May 6, 2024
Celebrities

Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

April 30, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version