• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home News World

Five tins to know about France young prime minister wey be gay

Sisi Eko by Sisi Eko
January 9, 2024
in World
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

France president Emmanuel Macron don appoint 34 years old Education Minister, Gabriel Attal, as im new prime minister on Tuesday.

President Macron appoint Attal as im prime minster as im dey try give new life to im goment second term for office, and as EU dey ready for parliament elections.

Even though dis move fit no lead to any major political change, Macron dey give signal say im go like move from di many palava wey im goment face last year wit pension and immigration reforms and also to improve im party chance for di EU elections.

Attal, one of Macron right handman, go replace Prime Minister Elisabeth Borne wey resign afta 20 months for office.

Throughout her tenure, Borne bin struggle wit lack of majority for parliament.

Gabriel dey enta eye and now, im main work na to lead di French goment enta di European Parliament elections wey for shele for June.

But wit di kain difficulty wey di president dey face for im second term – plus di challenge wey im dey face from di nationalist right – to “enta eye” alone fit solve di problem?

Handsome, youthful, charming, popular, strong, for sure Attal dey enta office wit clouds of glory – just like im mentor and role-model di president imsef.

But like many go-getters for im generation, na Emmanuel Macron idea of breaking apart di old left-right divide and re-writing di codes of French politics dey ginja am.

Dis na five tins to know about Gabriel Attal

Youngest French PM

Attal na di youngest prime minster for French history.

Im young pass Laurent Fabius wey bin dey 37 years wen François Mitterrand appoint am for 1984.

As Macron dey win 2017 elections, Attal become member of parliament, and na dia di president notice am.

At 29, im become di youngest ever minister of di Fifth Republic wit one junior post for education.

Im dey openly gay

Gabriel Attal go be di first openly gay prime minster for di kontri.

Na one of im old schoolmate na im expose am as gay for 2018 wen dem name am junior minister during Macron first term.

Im get civil partner wey be one of Macron former political adviser, MEP Stéphane Sejourné.

Member of Socialist Party

Attal join Socialist Party wen im bin dey 17 years.

Ten years ago im bin be one adviser wey nobody sabi for di kontri health ministry and card-carrying member of di Socialists.

Im rise sharply to become popular name for French politics afta im work as goment tok tok pesin during di Covid-19 pandemic.

Later im become junior minister for di finance ministry before im come become education minister for 2023.

E make name for im sef as one of Oga Macron cabinet-minister-wey-sabi, and im get sweet mouth no be small.

Ban Muslim abaya dress

Di first tin wey Arttal do as im become education minister last year, na to ban Muslim abaya dress for state schools.

Dis im action make am even more popular among conservative voters even though im come from di left.

Na for dis post Attal confam give di president say im get wetin e take, as im act wit no-nonsense determination to end di September gbege over Muslim abaya dress by just banning dem for schools.

Now im dey propose to experiment wit school uniform for schools for di kontri.

Victim of bullying

Recently, Attal go one popular TV show go tell tori of how one of im former classmates bully am wen im bin dey primary school.

Im say di classmate shame am for one blog wey dem create to rate di shape of classmates during the days wen internet first start.

Im lead one campaign against bullying – as par im imsef na victim – for di elite École alsacienne for Paris.

Betta Edu: One of di youngest ministers for Tinubu cabinet, her journey to Aso Rock and how she land inside controversy wey make dem suspend her

Tags: NewsViral
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
People

Di Ghana 2024 elections registration wey dey target 623,000 new voters

May 9, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version