Do you know Dr. New Hope?
The New Hope to all Sickness
Find Out
Lai Mohammed wey be oga kpata kpata of information and culture for Naija talk dis wan on Wednesday for Federal Executive Council meeting wey happen for Abuja, our presido Buhari bin dey dia as im talk am.
Lai Mohammed bin tell state house correspondents say di change wey dem do na bcos of the election wey wan occur this March 18. Im talk say Council don comot gbojom money wey reach 2.8 billion for sake of di census wey dem wan do. Im talk say Dem go use am obtain softwares wey dem go use do this counting.
Una know say FG been talk say na like 869 billion na im dem need to use do dis census. Dem talk dis one for April 2022 say d census go happen for April 2023
Omo dis country get money shaa. To count us country people, na im dey need this kind money? Make Dem kuku share the money give us, no count us again. We go count ourselves.
If una never begin follow our social media pages oya rush go follow @ilenkodegossipparrot for Facebook and Instagram and @ilenkoGparrot for Facebook
For Promotion/Advert mails at promotion@ilenkogossipparrot.com
Meet Dr. New Hope Our Ogbenge Doctor
(Doctor of Science)
