• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home People

FG confam death of Nigerian student for Canada afta police shoot am

Sisi Eko by Sisi Eko
January 5, 2024
in People, World
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Nigeria goment don vow to make sure say one 19-year-old Nigerian student wey police allegedly kill for Canada get justice.

Chairman of di Nigerians in Diaspora Commission, (Nidcom) Abike Dabiri-Erewa, describe di alleged killing of di Nigerian student for Manitoba, Canada, Afolabi Stephen, as “wicked”.

Inside statement wey di commission release on Thursday 4 January, 2024, wey di Director of Media and Public Relations and Protocol sign, di commission promise say dem go make sure say justice dey served.

“Di Nidcom boss receive di news wit shock. We dey in touch wit di Nigerians mission for Ottawa wey don get di assurances of di Canadian authorities say dem don start investigations into di unfortunate incident.

We offer our deepest condolences to di family and friends of Afolabi and pray unto God to allow im gentle and innocent soul to rest in perfect peace”.

According to di Nidcom statement, tori be say na policemen shoot di 19-year-old Nigerian, Afolabi Stephen, on December 31, 2023 for Manitoba, Canada.

Even though di details of im death neva dey clear like dat, di Winnipeg, Manitoba Police Department for statement wey dem post for dia website via Winnipeg.ca, say ” dia officers bin respond to one call about one young man wey bin dey act “erratically” (behave anyhow).

Di police note say wen dem arrive, efforts to calm di young man no work, e con make di police to shoot, wey lead to im ultimately death.

Di death of Afolabi Stephen don dey bring back conversations about how safe students for abroad dey.

And pipo don dey begin ask question why di policemen go use firearm (gun) to calm pesin down.

Di no be di first time tori of how students wey go study dey die for foreign lands sake of one reason or di oda.

Di Ghana chef wey wan break Guinness world record for longest cooking marathon

Tags: NewsViral
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
Lifestyle

‘My 17-year-old son die within six hours afta dem begin blackmail am with im fotos’

June 5, 2024
Nigeria

Light off, schools close, airports grounded as NLC strike witness ogbonge compliance

June 4, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version