Site icon ilenkogossipparrot

Facebook, Instagram, Threads error throw pipo into panic mood

Facebook and Instagram users for Nigeria suddenly discover say di networks sign dem out.

Di two social media platforms wey Mark Zuckerburg own just sign out all im users for Nigeria around 4:40pm local time.

Pipo wey try use di social platforms see say dem all dey automatically signed out.

Many social media users suddenly discover say dem no fit access dia Facebook and Instagram accounts again.

Tracking website Downdetector show say hundreds of thousands of pipo bin report say dem no fit get access to dia Facebook and Instagram, and dis affect many kontris.

Social interactions on di two platforms stop as pipo discover say dem no fit access services wey require login.

All attempts by users to sign back in no just gree work at all as all dem dey get say dis pass word incorrect response.

E neva clear wetin dey cause di downtime but Meta di parent company of Facebook and Instagram say den bin get issues but “e don dey work now.”

For im Status page, dia products bin experience major “disruption.”

“We dey aware of one issue wey affect Facebook Login. Our engineering teams dey seriously torchlight di mata to solve di issue as quickly as possible,” di page say.

Meanwhile Meta communications officer Andy Stone post for X: “We sbi say pipo dey face wahala accessing our services. We dey work on am now.”

Dis no be di first time wey Facebook and Instagram dey suddenly go down witout notice.

‘Dem naked di building’ – Inside Abuja warehouse wey hungry mob loot grain

Exit mobile version