Site icon ilenkogossipparrot

‘Eventful but predictable’ – How Russia Vladimir Putin claim im fifth term in office

Vladimir Putin wey don dey in power for 24 years don dey elected President of Russia for di fifth time.

Putin win a fifth term as Russian president afta recording 87% votes, according to Russian exit polls. Im no face any credible opposition candidate sake of say na di Kremlin dey tightly control Russia political system, media and even dia elections

Putin don already serve 20 years as president and four as prime minister, and for di age of 71, im don rule Russia longer dan any ruler afta wen Soviet dictator Josef Stalin bin spend 31 years in power.

Di Kremlin ensure say Putin no get any credible opponent and wit dat, e bin dey certain say im go secure a fifth term by wide margin.

President Putin say im win for di election go allow Russia to become stronger and more effective.

“Out of every voice, we dey build a common will of di pipo of Russian Federation,” Putin tok for im campaign headquarters.

Russian electoral commission bin award Putin more dan 90% of di vote for Donetsk wey Russia dey occupy.

Donetsk na di largest city for eastern Ukraine wey Russia don occupy and na wia Moscow dey boast most of dia loyalty.

Across polling stations for Russia, dem detain at least 80 protesters for acts of vandalism. Some of di reported incidents bin involve green dye wey dem pour into ballot boxes on Friday, as well as fireworks wey dem set off inside polling stations.

Russians bin cast dia votes across 11 different time zones between Friday and Sunday, but ontop di ballot, e no get any credible opponent to di incumbent leader.

How di world react to Russian election

Many Western authorities don criticise Russia election say e no dey free and fair.

President Volodymyr Zelensky of Ukraine refer to Putin as a “dictator” wey dey “drunk from power”.

“E no get any evil wey im no go commit to prolong im personal power,” Zelensky tok.

For di United States, one White House tok tok pesin say di election dey “obviously not free nor fair sake of how Putin bin imprison im political opponents and prevent odas from running against him.”

UK Foreign Secretary David Cameron criticise di vote on X wia im tok say “dis no be wetin free and fair elections look like”

Di German foreign ministry call di vote for Russia “pseudo-election” and add say “Putin rule na authoritarian, im rely ontop censorship, repression and violence”

Meanwhile, di Poland foreign ministry say e go dey “impossible to make a free, democratic choice” for di Russian election

Kim Jong Un of North Korea send congratulatory message give Putin as im win di Russian election.

Chinese foreign ministry tok tok pesin congratulate Putin. “We firmly believe say under di strategic guidance of President Xi Jinping and President Putin, China-Russia relations go continue to move forward”

‘Putin no be politician, im be gangster’- Alexei Navalny wife

Di wife of late Russian opposition Alexei Navalny say di pipo suppose stand against President Putin.

Yulia Navalnaya bin vote for Russian embassy wey dey Berlin wia she add say di West need to realise di kain pesin wey Russian president really be – a “gangster”.

For one of her op-ed for Washington Post several days earlier, Navalnaya say make Russians “no recognise Putin as di legitimate president of Russia.”

“I dey urge you to finally hear di voice of free Russia and take a stand against am (Putin) – no recognise di results of di falsified elections,” she write for her op-ed.

For her closing remarks, she say di world need to “finally realise say Putin no be who im appear to be. Na tyrant, a war criminal – and a murderer.”

Navalny bin die for prison inside di Arctic Circle, di prison service confam.

Dem see Navalny as di most vocal critic of President Vladimir Putin. E bin dey serve 19-year jail term for offences many pipo consider as politically motivated.

Di 47-year-old blogger – wey survive poisoning wit one nerve agent – die as e dey serve long prison sentence for February 2024, afta more dan three years for detention.

President Bola Tinubu, Delta state goment react to di killing of 15 sojas for Delta state

Exit mobile version