Di news come around 14:00. Paramedic Mahmoud al-Masry and di rest of im team bin dey for di al-Awda hospital for northern Gaza, wia dem bin dey wait for di next call-out.
Di despatcher bin announce say dem don hit ambulance 5-15 – Mahmoud papa team. Im be paramedic too.
Mahmoud and im colleagues rush to see wetin don happun.
Wen dem reach dia, dem see as di ambulance don turn to ordinary metal as e scatter by di roadside.
Mahmoud run go near di wreckage, but im see say evribodi wey dey inside “completely burn and tear into pieces”.
One BBC Arabic documentary wey dey follow paramedics for di first month of di war capture Mahmoud reaction as e realise say dem kill im father, Yosri, and two oda crew member.
“No brightess bin remain for im face again,” Mahmoud cry.
Na on 11 October, five days into di war.
Dem bin wrap Yosri Al-Masry lifeless body inside one white clothe, along wit im helmet wey blood stain.
For di burial, Mahmoud kneel down beside am, e dey wipe tears comot as e dey shake im head, im colleagues gada nearby.
Na journalist for Gaza, Feras Al Ajrami film dia stories for di documentary Gaza 101: Emergency Rescue.
Afta im papa death, 29-year-old Mahmoud, wey get three children of im own, take some weeks off.
But im bin tok say, even though im dey feel deep sadness, im bin wan go back to work.
“My inner drive na to serve di Palestinian pipo ,” e tok.
E set di wallpaper image for im phone to show im papa face,” so I fit see am, day and night”.
Dia last moments togeda na a couple of hours bifor Yosri die. Im bin don tell Mahmoud to make am a cup of coffee, wey im drink before afternoon prayers. Small time dem call Yosri ambulance and e comot.
Only two days earlier Mahmoud bin get injury, and dem bin carry am go hospital on stretcher wit shrapnel wey dey neck and back.
Im papa bin don dey by im side cry. “Im bin dey so worried,” Mahmoud tok.
But wen im tink of im father in di weeks afterwards, na di moments wey don pass by, wen dem destroy di vehicle na im tormessit alone, I relive am… I bin dey rush go towards di ambulance, I bin dey rush towards my papa, I dey shocked to see am scatter to pieces and I bin wan faint,” im tok.
Mahmoud bin don dey work as paramedic for seven years, and at di time, im bin dey base for Jabalia for northern Gaza, as part of one Palestine Red Crescent Society (PRCS) team.
Di documentary follow di ambulance crews from di unit over di month following 7 October, wen Hamas launch dia attack on Israel wey kill 1,200 pipo and taking about 250 hostage – and Israel begin dia serious military response.
Ex-SGF wash hand comot $6.2m cash Emefiele approve for foreign observers during election