• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Lifestyle Food

‘Dem naked di building’ – Inside Abuja warehouse wey hungry mob loot grain

Sisi Eko by Sisi Eko
March 4, 2024
in Food, News
0 0
0
0
SHARES
2
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

BBC Pidgin gain access into di warehouse belonging to di Federal Capital Territory wey some pipo bin break into and park grains on Sunday morning.

Di area dey inside one interior village wey dem dey call Tarsha 2, close to Idu Railway Station for Abuja, just afta di Idu industrial Layout.

One police oga wey tok to our reporter say wen im men first come to stop di looting on Sunday morning, dem bin no fit do much sake of di huge number of pipo wey attack di facility.

Dis oga wey no wan make we tok im name becos im no be di FCT police tok-tok pesin tok say im gatz mobilize more men from all di division around bifor dem fit to regain control of di warehouse.

“By dat time di whole place don dey empty. No be only food dem loot, dem also take anything wey dey of value for di buildings, doors, windows, toilet seats, plumbing wares, even di aluminum roofing sheets,” di police officer tok.

“But we don begin investigation and we don dey make arrests and we don even recover some of di stolen items.”

Our tori pesin observe say di buildings wey come under attack include one big warehouse, one smaller warehouse and two office buildings, plus two silos wia dem dey store grains.

Tori bin spread say di warehouse belong to di National Emergency Management Agency (Nema), but dem later clear di air say no be dia facility.

However, Nema tok say dem don beef up security for dia warehouses to prevent similar thing from happening.

Women still dey park maize wey trowey for ground

BBC Pidgin saw some women, and even some little children wey wear school uniform, as dem still dey park some of di corn wey trowey for ground wey pipo don even match foot.

One of di women tok say dem no get any choice sake of di high cost of food for market.

“My brother, if I reach house now, I go pour am inside water, di stones go go down and di corn go come up, I go take am feed my children,” she tok.

“As pipo dey struggle for food yesterday, you know say we women we no go fit join di struggle, na dis one wey don pour for ground we fit gather take feed family.”

We notice di presence of plenty police officers for inside and around di warehouse facility. Di police bin arrest some pipo as our reporter dey dia.

Some policemen follow one of di young men wey dem arrest enter im house wia dem see a small bag of corn for inside im room. Dem carry di man and di bag of corn put for dia car wey also get oda small small bags of corn wey dem collect from suspects wey dem arrest.

“Abeg make una give us one bag,” one of di women wey dey pick corn for ground beg di policemen, but dem no even look her side.

No be di first time

One man wey im workshop dey just beside di warehouse tok say dis no be di first time di warehouse pipo dey vandalise di warehouse.

“E bin don happun for around 2021, dat one dey worse pass dis one. Pipo pack even di wood for di roof, nothing remain,” di man tok.

“Na true say hunger dey di country, but if na only food dis pipo carry for here, I go understand, but why you go carry roofing sheet or toilet seat, you wan chop dat one too?” E ask.

Our reporter also see one young man wey wunjure during di looting spree. Di boy no fit waka after im fall from height as e dey drag bag of corn and land on im waist.

Im tell di BBC say pipo bin carry am go hospital but dem tok say im suppose do scan and as im no get money, dem carry am come back.

“Dat boy na orphan, e no get mama e no get papa. Im dey stay wit one of im relative wey dey help am, now see wetin don happen,” a neighbour tell BBC Pidgin.

Di Minister of State for di FCT, Ramatu Tijjani Aliyu, on Monday morning, don go see di extent of di looting, and she promise say security go dey beefed up and dem go rebuild di area.

Remember say dis kind thing bin don happen for Nigeria during di covid-19 lockdown period for 2020, when pipo begin dey vandalise goment warehouses and storage facilities dey pack food.

Right now, Nigeria dey experience tough time as di economy dey struggle.

Di removal of petroleum subsidy by President Tinubu immediately after taking office for May last year don cause hyper inflation, especially food.

Even sachet water, one of di most commonest things, dey sell for fifty naira for most cities now, from five naira wey be di price in 2015.

Five ways Nigerians dey cope as price of tins dey cost anyhow

Tags: AbujaWarehouse
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Politics

Ireland, Norway, and Spain to recognise Palestinian as state

May 22, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version