Nigerian musician Davido reply im colleague Wizkid on Monday night for im X handle afta a long day wey e bin troll am.
For post ontop im X account, Davido say im no get “notin to say na why im stop wasting im clout and “jeopardizing im millions of usd of endorsements on pesin wey im career dey resurrected few years ago just to die again. NEXT!!”
For comment section, Wizkid come reply am say im no get notin to say to Davido too, “I fit retire today and you still no go dey my level. You be influencer wit song writer. Wish you well ✌️.” Wizkid tok.
For anoda tweet, Wizkid tok say “you know wetin..no point. delusional niggas 😇 pray for you all.”
While Davido tok say im no dey delusional but Wizkid na “sick man.”
Na on Monday di superstar begin trend sake of di tins e begin write about im fellow celebrities.
Di Nigeria musician Wizkid surprise im fans wit many tins wey e write for social media as per say na pesi wey no dey too tok for social media.
For X, wey dem bin call Twitter, Wizkid start ova di weekend to dey tok about di plenty gist wey im get.
Di artist no be pesin wey dey tok too much – weda for social media or in real life.
But e start on Sunday, wen Wizkid post one kain message say, “Evri day I get tins to tok but my mouth no good..”
But e no stop am to troll online and pipo and di mata trend throughout on Monday for social media.
For im early thread wey im post enta Monday, Wizkid take style enta Davido, Don Jazzy as well as hail di controversial Prophet Chukwuemeka Ohanaemere, aka Odumeje.
So wetin be di oda tins wey im bin tok.
Wizkid vs Don Jazzy
For early mor-mor on Monday, one social media user, bring am to im attention say rapper Ladipoe don dey tok some kain tinz against Big Wiz.
For im reply, di singer respond say im no dey answer anybodi wey dey signed to influencer.
And as if to stamp down on im tok-tok, e go on to repost more tok-tok wey confam say na really Don Jazzy im dey tok about.
On dat mata Nigerians chook dia mouth inside as dem call out di Essence star, on wetin im tok about Don Jazzy.
E reach sotay pipo start to call di Essence crooner out on one old video wia e say, e bin sleep for Don Jazzy house.
As of now sha, Don Jazzy neva chook mouth on top how dem call am out.
Beg like Davido
No be new tori say Big Wiz and Davido beef don tey since e start.
Since di time wey di two of dem blow, e be like dia beef don dey for long even though Big Wiz bin show face for one of di earliest Davido music video.
Dia beef bin take break for 2017, wen di two both of dem show for each odas concert for dat year Detty December for Nigeria.
No be until 2023, wey dem go announce say dem bin dey go joint tour togeda but nothing comot from dat one.
For im troll thread, Wizkid howeva put video of Davido wia e dey keel down beg, tell im fans say make dem beg like dat if dem wan make im comot wit new music.
Davido and Wizkid banter for X
Davido reply Wizkid yesternight for im X handle say im no get notin to say na why im stop wasting im clout and “jeopardizing im millions of usd of endorsements on pesin wey im career dey resurrected few years ago just to die again. NEXT!!”
For comment section, WQizkid tok say im no get notin to say to Davido “I fit retire today and you still no go dey my level. You be influencer wit song writer. Wish you well ✌️,” @wizkidayo.
For anoda tweet, Wizkid tok say “you know wetin..no point. delusional niggas 😇 pray for you all.”
While Davido tok say im no dey delusional but Wizkid na sick man.
Davido also shade Wizkid say na size 7 e dey wear ” Size 7 shoe 😂 nigga shop for Footlocker kids.”
Wizkid tok say im “don tire I Dey go sleep 😂 Jesus na King.”
Indaboski to Intro Big Wiz Next tour?
Big Wiz from im trending X thread reveal how di video of popular controversial Prophet Odumeje sweet am for belle.
For X, e tok say di video wey Flavour and di Prophet do togeda na im favourite for life and come put am say e go be di intro for im next tour.
Recently, di pastor wey im real name na Chukwuemeka Cyril Ohanaemere bin just run im own concert for London.
Even wit how pipo dey follow am dey cruise on top social media as e dey hot, some pipo dey compare Big Wiz to Kanye on top di new album wey im dey release, Morayo.
Becos dis no go be di first time dis year, wey Big Wiz go come for pipo inside social media
For March e comot say, e no want make pipo dey call am Afrobeats artiste again, and even though im explain im points, e no resist di urge to swear for pipo sotay im tell dem say if dem like make e no stream di new album, Morayo.
Dis dey come afta years wey Wizkid FC dey hpe di way Big Wiz no dey too chook mouth for mata and just dey find im own level.
As e come dey tok now pipo don dey comment on top di mata.