Congratulations choke for instagram as popular dancer, Janemena and hin husband, Andre Plies broadcast say dem dey expect another pikin.
D influencer been enta her IG page share d jolli news as her family don dey grow. She con drop video as she dey show her big belle with her husband and her pikin.

D couple been marry for december 2019 and dem con welcome deir first pikin for november 2022.
Na so Janemena take write for d video wey she post,
“14 years and i still dey love d same man and you!?
Our best oops ever!!!
Big gbosa to dem o!
Watch d video wey she post,
https://www.instagram.com/reel/CxpjLCJtECc/?igshid=MzRlODBiNWFlZA==
BBNaija All Stars: Adenita don break up. Read full gist (video)