ilenkogossipparrot

Daddy Freeze no go church again because of wetin pastor tell am.

Media personality Daddy Freeze don yarn the reason why hin quit church because of how hin pastor dey do am.

Hin tok say hin pastor caution am say make he no sit for front seat for church again.

Daddy freeze been drop the gist for one episode for Teju babyface “Deep dive” audiovisual podcast.

He con add tok say the pastor use hin mouth tell am say make he Dey siddawn for back chair because say hin divorce hin wife.

D sociomedium influencer tok say hin be church worker wey dey do one or two for the church. Because of wetin sup, he con conclude say e beta make he no kpata kpata Dan say he go sit for back chair.

Freeze con tok say he con dey learn Bible for house con see say many church dey do wetin no dey for Bible and e no good.

Na so he take tok am:

”my marriage don too get many katakata and for 2014 na when e end. I remember say I Dey do church waka. D church minister sef dey pay me to do event for church. Atleast the pastor no dey chop all d money, he Dey share am give people wey follow work. Dem book me for church say make I run one event but later dem con call me say make I cancel am say na because say I do divorce or say I get divorce palava. I con think am say na because say I wan divorce na hin make God comot eye for my mata?. D pastor come my house, we con get tok. He tok say he no dey tell me say make I no come church again but say make I Dey sit for back. Na hin make I just jeje sidawn for house instead make I go church dey hide face for back. Na so to dey stay house con dey help me reason some kyn things wella wey dey happen for church.

“Kpanshing no good”- Bolanale Olukanni dey yarn us why e good make you comot hand for kpanshing

Exit mobile version