Popular Nigeria Television Authority Newscaster Aisha Bello Mustapha don die after a brief illness for Abuja.
Di presenter wey be popular face on Nigerian televisions in di 90s and early 2000s retire from NTA for May 2022.
Zainab Sabo wey be friend of Aisha family confam di death and add say her funeral prayer go take place for Abuja Central Mosque by 1pm on Monday.
“Na true say Mama (Aisha) don die and her funeral prayer na 1:00pm we go really miss her and we pray for God to bless her soul” Zainab tok am
After 35 years work with di Nigeria Television Authority (NTA), Aisha retire for May 2022, wey conclude her remarkable career for di broadcasting industry.
Aisha dey versatile and her skill set include journalism, television production, broadcasting, editing, and her last role na as di General Manager of NTA Parliament before retiring.
Di professional manner and her unique style solidify her as one of NTA most popular faces and voices, leaving a big mark for di Nigerian broadcast industry.
Aisha legacy for Nigerian media dey big. She bin start her journey at NTA, rising to di role of assistant director of news and later becoming di general manager of NTA Parliament and also featuring as one of di popular broadcasters on NTA Network News during di ’90s and early 2000s.
In terms of education, she bin earn a Bachelor’s degree for Mass Communication/Media Studies from Ahmadu Bello University wey dey Zaria for Kaduna state.
Gunmen don kidnap students for Nasarawa university community