ilenkogossipparrot

Christmas messages from leaders around di world

As millions of pipo around di world dey celebrate Christmas Day wit dia families and friends, millions more dey trapped inside conflict, hardship and suffering.

And na so e be for some of dem for most part of di year. Dis na part of wetin inform leaders across di world as dem deliver dia Christmas messages.

Dis na some of di messages from around di world.

President Bola Ahmed Tinubu

Nigeria President Bola Tinubu don assure Nigerians say im administration go continue to implement palliative measures wey go ease di burden wey di removal of fuel subsidy don create for kontri pipo.

Di Nigerian leader wey felicitate wit kontri pipo on Christmas day celebratiuon also promise say in short time, Nigeria go enta into “a new dawn of prosperity, peace plus irreversible progress.”

Di Nigerian leader give dis assurance for one Christmas message wey im personally sign.

“My administration go continue to implement palliative measures to ease di burden on di most vulnerable, address current hardships and remove di suffering of all our kontri pipo,” Oga Tinubu promise for im first Christmas message to Nigerians as Presido.

Dis na as e call on Nigerians to show di best of Christ and extend kindness to everyone wey dey around dem.

E say make dem believe in im commitment to rule wit vision, dedication plus empathy.

“Dis year don be time of transformation and relentless change for our kontri. And I dey aware say di necessary reforms we dey implement to achieve more prosperous, peaceful kontri for all get imposed unique sacrifices.”

Pope Francis

For di Vatican, Pope Francis dey preside ova Christmas Eve midnight Mass for St Peter Basilica

Pope Francis don beg for peace against di “futile logic of war” during Christmas Eve mass.

Di Pope tell worshippers for Saint Peter Basilica for di Vatican say: “Tonight, our hearts dey for Bethlehem, where dem once more reject di Prince of Peace sake of futile logic of war, by di clash of arms wey today no allow am find room for di world.”

President Joe Biden

America President Joe Biden Christmas message dey very short.

E post for X (former Twitter) say wetin im wish for pipo all ova di world na make dem take few moments of quiet reflection and find dat stillness wey dey for di centre of di Christmas story.

“May you find peace in dis silent night. And warmth from those surrounding you.” Oga Biden tok.

Archbishop of Canterbury

Di Archbishop of Canterbury go say “violence dey for so many parts of di world”

Di Archbishop of Canterbury go speak about children wey dey affected by di Israel-Gaza war for im Christmas Day sermon.

Di Most Reverend Justin Welby dey expected to tok say “skies of Bethlehem dey full of fear instead of angels and glory” during one service for Canterbury Cathedral on Monday morning.

E go also tok about di victims of violence for Ukraine and Sudan.

E dey expected say Oga Welby go compare di troubling background of Jesus upbringing wit di struggles of children for di region today.

President Volodymyr Zelensky

Many Ukrainian Orthodox Christians dey prepare to celebrate Christmas on 25 December for di first time dis year.

Before now, Ukraine bin dey traditionally use di Julian calendar, di same one wey Russia dey use, wia dia Christmas fall on 7 January.

In a further shift from Russia, dem dey mark Christmas now according to di Western – or Gregorian – calendar, wey dem dey use for dia everyday life.

Ukrainian President Volodymyr Zelensky bin change di law for July, e tok say Ukrainians dey allowed to “abandon di Russian heritage” of celebrating Christmas for January.

For inside one Christmas message e issue on Sunday evening, Oga Zelensky say all Ukrainians dey together now.

“We all celebrate Christmas together. On di same date, as one big family, as one nation, as one united kontri.”

President Emmanuel Macron

France president Emmanuel Macron remember di fight-fight wey dey go on for Gaza for im Christmas message.

E post on X say “Solidarity wit Eastern Christians plus civilians of all faiths wey dey faced wit war and violence, especially those wey don see refuge for di Latin parish of Gaza.

President Nana Akufo-Addo

For im Christmas message, Ghana president Nana Akufo-Addo dey thankful say afta three difficult years, tins don dey get beta for di West African kontri.

E say inflation don dey under control, dem dey experience relatively stable exchange rate plus dia economy don dey bounce back.

Although, e tok say di kontri neva recover fully, growing confidence dey say wit hard work and determination, Ghana go make am and dem go secure dia future.

Di Ghanaian leader chook mouth for di 7 December, 2024 general elections. E say everybody get duty to themselves for manner wey go bring about free, fair and transparent election wey go enable Ghanaian pipo choose in peace pesin dem want to manage dia affairs for di next four years.

“I remain committed to di mandate una freely give me. I go use di last year of my stay for office, to do all in my power to continue to help create free and prosperous nation of opportunities wia every Ghanaian child, no mata di circumstances of his or birth, get fair chance to strive for a happy and dignified life and realise his or her aspirations.”

South Africa leader

South Africa government tok say dis Christmas season na time to celebrate di kontri successes plus acknowledge some of di challenges of di year.

Di kontri deputy president Paul Mashatile for im Christmas message highlight some ogbonge tins wey goment don do to improve di lives of di pipo like access to educations, access to early childhood development, access to electricity and water.

E add say “since Christmas na time for giving, we must renew our commitment to each oda as families and friends. We must remind each oda about di values of Ubuntu, umuntu, ngumuntu ngabantu. Dis na time for us to show love and care for each other,” e tok.

Israel-Hamas war, Turkey earthquake, Hilda Baci record – 13 events wey shake 2023

Exit mobile version