Wunmi wey b wife of d singer wey just die wey hin name na Ilerioluwa Oladimeji Aloba wey people sabi am as Mohbad don enta sociomedium mourn hin death.
Na so she take pack pictures full for her IG story as e be say she don Dey with the singer for 10years and dem get 5months old pikin together.
She con open up say d singer don Dey fight depression and nothing Dey make am happy again and he been want make her and d pikin go abroad go stay so he go fit run everything on e own.

The heartbroken lady say na so she take be widow for age 24 and con dey wonder how she go take live her life and raise her pikin on her own.
Remember say d 27 year old singer been die on Tuesday 12 September and laidis now e get some kyn tok tok wey we never sure say na d cause of hin death.




