• Login
ilenkogossipparrot
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
  • Home
  • Politics
  • World
  • Entertainment
    • All
    • Sports
    created by photogrid

    Ice Sleek, Rema looklike don finally surface

    Davido react afta Wizkid drag fellow celebrities

    WETIN MAKE ICESLEEK DROP THIS NEW GBEDU “NO GREE”

    ICESLEEK AKA INDUSTRY BABY DON RELEASE NEW JAM “NO GREE”

    Why America wan ban TikTok plus oda kontries wey don ban or dey eye am

    How Super Eagles of Nigeria reach Afcon final afta ten years of no show

  • Business
No Result
View All Result
ilenkogossipparrot
No Result
View All Result
Home Entertainment News

Bobrisky sentenced to jail – which prison dem go keep am?

Sisi Eko by Sisi Eko
April 13, 2024
in Entertainment News, Nigeria
0 0
0
0
SHARES
1
VIEWS
Share on FacebookShare on TwitterShare on whatsapp

Court don sentence ogbonge Nigeria celebrity Idris Olanrewaju Okuneye wey pipo sabi as Bobrisky to prison.

Justice Abimbola Awogboro deliver di six-month sentence to ‘Bobrisky’, wey don dey detention since dem first arrest am.

Di court pass di sentence wit no option of fine. Di Crossdresser go dey for di Ikoyi correctional centre.

Na on Friday di judge bin give di judgment for di Federal high court for Lagos.

As pipo bin dey ask which kain prison im go come dey, di judge bin refer to am as ‘he’ for court.

Dis mean say na di prison wey suit im biological gender dem go keep am as di court and even di EFCC refer to am as ‘he’- a male gender.

According to di Central bank act 2007 (section 21), na offence to dey spray money or match di money wey di central bank bin print.)

Di act recommend a punishment of six months, option of fine or both.

Meanwhile, lawyer to Bobrisky Ayo Olumofin bin first tok say im client na first offender and make dem treat am like dat.

Di judge rule say Bobrisky jail term start on 24 March, wey be di day wey dem first arrest am.

Wetin judge tok for court ontop Bobrisky matter

Justice Awogboro wen im dey tok say to dey abuse di naira don become too much wahala and e gatz stop.

“to dey abuse naira don dey become serious problem and e dey damage di image of di kontri. E don do make pipo dey abuse di currencies and e gatz stop. Dis go serve as lesson to odas”, di judge tok.

Wetin be di charges?

According to di charges wey EFCC sama Bobrisky, dem say im tamper wit di sum of N400,000 wey im spray while im dey dance for one social event wey happun for Lekki area of Lagos on 24 March 2024.

Di prosecutor Rotimi Oyedepo, SAN, wit seven oda lawyers also charge Bobrisky sake of say im tamper wit di sum of N50,000 wey im spray for Ikorodu between July and August 2023 wen im dey dance for one social event.

EFCC also accuse Bobrisky of spraying N20,000 for one event for Ikeja while dancing for December 2023 and anoda N20,000 for Victoria Island area of Lagos.

Court bin convict Bobrisky afta im plead guilty to naira abuse.

Na Justice Abimbola Awogboro of di Federal High Court for Ikoyi convict di crossdresser.

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin carry Bobrisky go court ova case of money laundering and spraying of naira notes.

Bobrisky bin appear for court last Friday to face six count charges wey surround money laundering and di abuse of di naira plenti times.

Wen dem read di charges, Bobrisky pleaded guilty to di first four counts bordering on naira abuse.

Di EFCC strike counts four out of di six.

Dem say Bobrisky dey trade but im no submit a declaration of di activities of im company.

Bobrisky gbege wit money laundering

For di number five and six count charges, EFCC say Bobrisky commit offence wey dey contrary to Section 6(1)(a), and Section 19(1) (f) of di Money Laundering (Prevention And Prohibition) Act and punishable under Section 19 (2) (b) of di same Act.

EFCC say Bobrisky get one company wey dem pay about N127.7 million inside and im no submit di activities to di Special Control Unit Against Money Laundering between September 2021 and April 2024.

For di last count charges wey EFCC sama am, Bobrisky no submit di declaration of di activities of im company wen anoda N53 million enta im account again.

However, for court, di EFCC say dem don follow Bobrisky tok and im don cooperate on how dem go sort dat part.

Who be Omobayo Godwins – govnor Obaseki new deputy?

Tags: BobriskyEFCC
Sisi Eko

Sisi Eko

Related Posts

Nigeria

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024
Nigeria

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024
News

Labour unions outline grounds for suspending nationwide strike as dem tok wetin go happun next

June 5, 2024
Facebook Twitter Youtube Instagram
ilenkogossipparrot

We provide you with the latest breaking news and videos straight from the entertainment industry.

Follow Us

Category

  • News
  • Entertainment
  • Music

Recent News

Hunter Biden: US president Joe Biden only surviving son go go jail?

June 12, 2024

New minimum wage and oda highlights of Tinubu Democracy Day speech

June 12, 2024

Push for six-year single term for president, govnors – wetin lawmakers wan achieve

June 11, 2024

Plane wey carry Malawi vice president don miss

June 11, 2024

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Welcome Back!

Login to your account below

Forgotten Password?

Retrieve your password

Please enter your username or email address to reset your password.

Log In

Add New Playlist

No Result
View All Result
  • Home
  • News
  • Politics
  • Business
  • Entertainment

© ILENKOGOSSIPPARROT 2023
POWERED BY KING TECH

Are you sure want to unlock this post?
Unlock left : 0
Are you sure want to cancel subscription?
Go to mobile version