Site icon ilenkogossipparrot

BDC operators, market react to EFCC clampdown as goment continue to try save di naira

Di Nigeria goment don continue dia raid on Bureau De Change, BDC, operations for various parts of di kontri as part of efforts to help stabilise di naira against di dollar.

Dis raids against di BDC operators on Wednesday happun for Abuja, Lagos, Ibadan, Kano, Enugu, Aba, and Port Harcourt.

Officers of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) wey wear plain clothes arrest plenty BDC pipo and di accuse be say na dem dey do wuru-wuru wey dey make di value of di naira against di dollar to dey drop.

Coordinated nationwide raids

For Enugu State, EFCC and CBN personnel swoop in suddenly on di BDC pipo for Asata area.

Dem carry dia moto block di two roads leading to di area, and dis cause commotion as pipo begin run helter-skelter.

BBC reporter wey witness di operation tok say e last pass four hours before di law enforcement pipo comot with some BDC operators wey dem arrest.

Same tin happun for Port Harcourt, di capital of Rivers State, for South-South Nigeria, wia one BDC operator, Muhammed Dari, confamm to BBC Pidgin say EFCC bin arrest pipo on Wednesday.

Di raid happun for Hotel Presidential area wia BDC operators dey stay, along di Aba-Port Harcourt expressway, by Rumuola.

According to Dari, “no bi mata of registration, dem arrest both di pipo wey register and di ones wey no register”.

Dari no gree give details of how di raid take happun dia, but e tok say normal activities don resume as at Thursday morning.

For Kano, di commercial nerve centre for Northern Nigeria, na di same format of plain-cloth EFCC officials wey carry out di arrests on Wednesday.

One BDC operator for Kano wey witness di raid tell BBC Pidgin say: “Dis raid no be di solution. Our pipo na just commission agents. E go beta make dem tackle di problem through good monetary policies.”

‘No struggle to liberate a kontri dey come easy’ – Labour Party chairman tok afta police release am

Exit mobile version